Psalm Chapter 93

Abeg share
  1. Na Baba-God dey-on-board, he baffup like king; Baba-God baffup like king and
    he get strength like weapon. E don createdi di world gidigam; e no fit move.
  1. E don tey wey you stand your throne don dey; you don dey since before di
    starting.
  2. Di seas don rise up, Oh Baba-God, di seas don rise up dia voice; di seas don rise
    up hin heavy waves.
  3. You get power pass thunder ontop big water, you get power pass sea
    breakers—Baba-God wey hin level high get power.
  4. Your laws dey stand gidigbam; Oh Baba-God, na holiness make your caban fine
    well-well forever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *