- Oh Baba-God, di God wey dey avenge. Chai Baba-God wey dey avenge, shine
for us.
- Rise up, Oh judge of di earth; pay back dis pipo wey dey make-mouth—wetin
dem deserve.
- Oh Baba-God, how long wicked pipo, how long wicked pipo go dey jubilate?
- Dem dey misyarn; all di evil doers sabi make-mouth well-well.
- Dem nack your pipo for ground, Oh Baba-God, dem oppress your inheritance.
- Dem kill woman wey her husband die and jjc; dem kill pipo wey no get palee.
- Dem sey, “Baba-God no dey see; di God of Jacob no dey hear pesin.”
- I dey warn una, wey no get sense for di community; mugu dem, wen una go get
akonuche?
- Abi you think sey me wey give una ear no dey hear word? Abi me wey form
eyes no dey see?
- Abi me wey dey correct nations no dey punish? Abi me wey dey teach man no
know anytin?
- Baba-God know wetin man dey reason; he know sey dem dey useless.
- Blessed na di man wey you dey correct, Oh Baba-God, di man wey you dey
teach from your law;
- you dey cool am down from days of wahala, until evil pipo enta grave.
- Baba-God no go bone hin pipo, he no go ever fashi hin inheritance.
- Judgement do dey inside rightrouesness again, and pipo wey get clean heart
go follow am.
- Who go stand up epp me fight evil pipo? Who go hold ground for me, con
change am for badbelle pipo?
- I for don shut-up for inside grave if to sey no be Baba-God wey con epp me.
- Wen I tok sey, “My leg dey dror-fall,” na your love, chai Baba-God, nahin
support me.
- Wen my body dey shake wit fear, na you cool my soul wit joy.
- Abi corrupt throne fit be your padi—throne wey dey bring suffer-head wit dia
law?
- Dem gather together wan change am for righteous pipo, con comdemn
innocent pipo to death.
- But na Baba-God be my strong-house.
- He go repay dem for dia sins, con scata dem becos of dia wickedness; Baba-
God wey be awa Oga go dabaru dem.
Post Views: 70