Seven Angels Wit Seven Disease
- I see anoda elele sign for heaven wey surprise me: Seven angels wit seven last diseases—last, becos na dem complete di vex wey Baba-God dey vex.
- I con see sometin wey be like big-river of glass wey dem mix wit faya, and those pipo wey don succeed against di beast [wild animal] and hin image, and wey succeed over di numba of hin name—con stand on di big-river of glass. Dem carry harp [music instrument] wey Baba-God give dem.
- And dem con dey sing di song of Moses—di servant of Baba-God, and di song of di Lamb: “Oga Baba-God Almighty, your works na ogbonge and elele. Your ways dey right and true, Oh King of all hin pipo.
- Oh Oga, who no go fear you, con cut-cap for your name? Na only you dey holy. All nations go come worship you, becos your judgement don show-face.”
- Afta dis tins, I look, and for heaven, I con see inside di worship-place of di Tent of Baba-God agreement, and e open.
- Di seven angels wit di seven disease come out from di worship-place. Dem dress wit white and shining linen, con wear golden cloth round dia chest.
- Naso one of di four living tins give di seven angels—seven golden bowls wey full wit di vex of Baba-God—wey dey live for ever and ever.
- Naso smoke from di levels and pawa of Baba-God—con full di worship-place, and no- pesin fit enta di worship-place until di seven diseases of di seven angels don finish.
Post Views: 50