Di New Jerusalem
- I con see new heaven plus new earth, and di old heaven plus di old earth don pass go, and di big-river no dey again.
- I see di Holy city, di new Jerusalem dey come down from heaven, from Baba-God, dem prepare am like woman wey wan marry—wey dem dress well-well for her husband.
- I con hear one loud voice from di king-chair wey tok sey, “Now Baba-God don dey stay among hin pipo, he go live wit dem. Dem go be hin pipo, and Baba-God hinsef go dey wit dem, con be dia God.
- Baba-God go wipe everi water komot from dia eyes. Death no go dey again, or cry-cry or pain—becos old way of tins don pass komot.”
- Di Pesin wey sidon for di king-chair con tok sey, “I dey make everitin new!” He con tok sey, “Write dis tin down, you fit trust dis words, and e dey true.”
- He still tell me sey: “Okpari! Na me be di Alpha and Omega, di starting and di finishing. Any-pesin wey water dey hungry, I go give am drink as awoof, from di water of life wey dey flow.
- Everi-pesin wey succeed—go inherit all dis blessing, and I go be dia God, and dem go be my pikin.
- But pipo wey dey fear, unbelievers, corrupt pipo, killers, pipo wey dey sex anyhow, pipo wey be witch [kpians], pipo wey dey worship idol, plus everi-pesin wey dey tok lie—dia place go dey for hot river wey dey burn wit faya plus sulfur. Dis na di second death.”
- So one of di seven angels wey carry di seven bowls wey full wit di seven last diseases, con tell me sey, “Come, I go show you di woman wey wan marry, di Lamb wife.”
- He con carry me for spirit—go one ogbonge high mountain, he con show me di holy city—Jerusalem, as e dey come down from heaven, from Baba-God.
- E dey shine wit di levels of Baba-God, and e dey shine like jewel wey precious well-well, like jasper, and clear as crystal.
- E get big high wall wit twelve gates, and wit twelve angels for di gates. For di gates, dem write di names of di twelve tribes of Israel.
- Na three gates dey for di east, three for di north, three for di south and three for di west.
- Di wall of di city get twelve foundation stones, and on top of dem—dem write di names of di twelve apostles of di Lamb.
- Di angels wey follow me tok—get ruler of gold—to measure di city, e gate, and e wall.
- Di city be like square, e high as e take wide. He measure di city wit di ruler, con see sey na 2,400 kilometers high, and 2,400 kilometers wide.
- Di angel measure di wall wit human measurement, and na 216 feet high.
- Dem make di wall wit jasper, and dem make di city wit pure gold, wey pure like glass.
- Dem design di foundations of di city wall wit everi kain precious stone. Di first foundation na Jasper, di second na sapphire, di third na chalcedony, di fourth emerald,
- di fifth sardonyx, di sixth sardius, di seventh chrysolyte, di eight beryl, di ninth topaz, di tenth chrysoprasus, di eleventh jacinth, and di twelfth na amethyst.
- Di twelve gates na twelve pearls, dem make everi one of di gate wit single pearl. Di great street of di city na pure gold, like clear glass.
- I no see any worship-place for di city, becos Oga God Almighty and hin lamb na di worship-place.
- Di city no need sun or moon to shine put, Baba-God levels dey give am light, and di Lamb na e lamp.
- Di nations go use e light see road, and di obas of di earth go carry dia beta-beta-tins enta am.
- No day wey dem go ever close di gate of di city, night no go dey for there.
- Dem go carry di levels and honour of di nations enta am.
- Anytin wey no pure, no go ever enta di city, or any-pesin wey do wetin dey bring shame, or wey be 419, but only those pipo wey dem write dia name for di Book of Life of di Lamb.
Post Views: 54