Di Book And Di Lamb
- I con see one book for di right hand of di Pesin wey sidon for di king-chair. Dem write for di two side, and dem seal am wit seven seals.
- Naso I see one strong angel dey tok wit loud voice, “Who get levels reach—to break di seals and open di book?”
- But no-pesin for heaven or for earth, or for under di earth fit open di book, or read am, or even to look am.
- I cry well-well becos no- pesin get level reach—to open di book, or read am, or even to look am.
- Naso one of di senior- men con tell me sey, “No dey cry! See, di Lion of di tribe of Judea, di Root of David, don win—to open di book and loose di seven seals.”
- I con see one Lamb, wey be like sey dem don kill—dey stand for di middle of di king-chair, and di four living tins [beasts], and among di twenty-four senior-men sef. He get seven horns plus seven eyes, wey be di seven Spirits of Baba-God—wey he send out go all di earth.
- He come, con carry di book from di right hand of di Pesin wey sidon for di king-chair.
- And wen he don carry di book, di four living tins [beasts], plus di twenty-four senior-men fall for ground for front of di Lamb. Everi one of dem get harp [musical instrument], and dem carry golden bowls wey full wit incense, wey be di prayers of holy-pipo.
- Dem con dey sing new song: “You get levels to carry di book and to open e seals, becos dem kill you, and you use your blood take buy men for Baba-God, from everi tribe and language,plus pipo and nation.
- You don make us to be kings and priests, to serve awa God, and we go reign for earth.”
- So I look again, and hear di voice of plenty angels round di king-chair, di living tins [beasts], plus di senior-men—wey plenty reach ten thousands times ten thousands, and thousands upon thousands,
- Dem con dey sing wit loud voice: “Di Lamb wey dem kill get levels, to receive pawa and riches, plus wisdom and strength, and honour, plus levels, and praise!”
- Naso I hear everi living tin for heaven and for earth, under di earth, and for di big-river, and everitin wey dey inside dem—dey sing: “Blessings and honour, plus glory and pawa, to di One wey sidon for di king-chair—and to di Lamb for ever and ever!.”
- Naso di four living tins tok sey, “Iseee,” and di senior-men con fall for ground—dey worship di Pesin wey dey live for ever and ever.
Post Views: 33