Ruth

  • Ruth

    Ruth Chapter 4

    Boaz Marry Ruth So, Boaz go di gate of di town, con sidon for there, and di family member wey Boaz bin tok about con dey pass there; so Boaz tell am sey, “Come here my padi, sidon.” So di man go meet am con sidon. Boaz carry ten of di senior-men of di town, con tok sey, “Sidon for here.” And dem sidon. He con tell dat hin family-pesin sey, “Naomi wey don come back from di Moab kontri, dey sell di land wey belong to awa broda Elimelech. I reason sey make I tell you sey, ‘Buy am back for-front of di kontri pipo and for-front of di…

  • Ruth

    Ruth Chapter 3

    Ruth For Di Harvest Ground One day, Naomi her moda-in-law, con tell her sey, “My daughter, make I fyne house for you, where dem go take care of you. Abi Boaz wey you dey stay wit hin girls no be awa family-pesin? Now listen, he dey komot di seeds from hin barley dis night for hin harvest ground. Wash yoursef and make you use perfume for your body, con wear your best cloth. Den make you go where he dey harvest, no let am know sey you dey for there, until he don chop and drink finish. Wen he lie down, look di place where he dey lie down put.…

  • Ruth

    Ruth Chapter 2

    Ruth Meet Boaz Naomi get family-pipo from her husband side, from di family of Elimelech, one bigman wey get moni, and hin name na Boaz. So Ruth di Moabite con tell Naomi sey, “Make I go farm wey dem dey harvest, to pick some corn from any place wey dem fit show me favour, con allow me gada am. So Naomi ansa her, “Okay my daughter, carry-go.” So Ruth komot go gada fruits, con dey waka for back of di pipo wey dey harvest, con dey pick wetin dem remain, e con happun sey she dey for di farm wey belong to Boaz. Na dat time Boaz come from Bethlehem,…

No copy from dis website