Songs of Solomon Chapter 7
Di Man Dey Praise Di Woman
- See as your legs fine wit sandals, oh daughter of prince. Di way your hips take curve be like jewelries, like di handwork of artist.
- Your navel be like round cup wey dey always brekete wit fine wine; your waist be like wheat wey dem gada wit lily flowers round am.
- Your two breast be like two small deer* wey be twins of gazelle.
- Your neck be like tall-house wey dem make wit ivory; your eyes be like di shinning fish-pond for Hebron, near di gates of Bathrabbim. Your nose be like di tall-house of Lebanon wey dey face Damascus.
- Your head be like crown for your body like mountain Carmel, and your hair for your head be like purple; di way your hair fine reach—fit hold king for work.
- See as you fine and see as you sweet, oh love, wit all your sweetness!
- Your body be like palm tree, and your breasts be like grapes wey gada for one branch.
- I con tok sey, “I go climb dis palm tree, I go hold di branch; now your breasts go be like vine fruits wey gada for one branch, and your nose dey smell like apples;
- Your kiss dey taste like di best wine—wey dey go down wit smoothness for my love , wey dey flow jeje to move di lips of pesin wey dey sleep.
Di Woman Promise Her Love
10. I belong to my love, and na me he dey tink about.
11. Come my love, make we komot go di field; make we go lodge for inside di villages.
12. Make we wake up for early mor-mor, con go di grape-farms; make we go see if di vine trees don dey grow, make we go see if di small grapes don show-face, and if di pomegranates don dey grow. Na for there I go give you all my love.
13. Na for there di mandrakes dey give dia scent, and di finest fruits go dey for awa doormot, both new and old, wey I don keep for you, my love.