Zechariah Chapter 13
Di End of Worshipping Idols
- On dat day, water wey dey flow go open for di House of David, plus di pipo wey dey live for Jerusalem, to clean dem from dia sins plus dia yama-yama.
- “E go happun on dat day, sey I go komot di names of di idols from di land, and no pesin go remember dem again,” naso Baba-God Almighty tok, “I go still pursue both di prophets and di spirits wey no clean—komot from di land.
- And e go happun sey, if any pesin still dey prophesy, hin papa and hin mama wey born am go tell am sey, ‘You must die, becos you don use Baba-God name take tok lie.’ Wen he prophesy—hin own mama and papa wey born am—go shuuk am.
- “E go happun sey, on dat day, shame go catch di prophets for everi of hin vision wey he dey prophesy. No pesin go pretend to be prophet by wearing prophet clothes.
- But he go tok sey, ‘I no be prophet. I be farmer; I start to dey serve for farm since wen I be boy.’
- And pesin go ask am, ‘Which wounds be all dis ones for your hands?’ He go ansa dem sey, ‘Na wound wey I wound for my padi house.’
Di Shepherd Savior
7. “Oh sword, wake up, con attack di shepherd wey dey work for me,” naso Baba-God tok. “Nack di shepherd down and di sheep go scata; den I go turn my hand against di small ones.
8. And e go happun for di whole land,” naso Baba-God tok, “Two parts go cut komot, con kpeme, but di third part go survive.
9. I go carry di remaining third part pass tru faya; I go make dem pure as dem take dey make silver pure, con test dem like gold. Dem go call my name and I go ansa dem; I go tok sey, ‘Dem be my pipo,’ and dem go tok sey, ‘Baba-God na awa God.’ ”