Psalm Chapter 89
Baba-God Agreement Wit David
- Dis na Maskil of Ethan di Ezrahite. I go sing about Baba-God mercies forever, wit my mouth, I go tok about Baba-God faithfulness to all generations.
- I don tok sey—“Mercies go stand gidigbam forever, and you go stand your faithfulness kamkpe for inside heaven.
- “I don make agreement wit di pesin wey I choose, I don swear to David my servant sey,
- ‘Your pikin-pikin-pikin go stand gidigbam forever, and I go build your king-chair for all
generations.’” - Di heavens go praise your wonders, oh Baba-God, and your faithfulness sef—for
where di holy-pipo gada put. - Who dey for heaven wey dem fit use take compare Baba-God? Who be like Baba-God
among di sons of di great ones? - Dem dey fear Baba-God wella—for where hin holy-pipo gada, and everi pesin wey dey
for hin side dey respect am. - Oh Baba-God Almighty, who get pawa like you, oh Baba-God? Your faithfulness
sef surround you. - Na you dey control di big-big-rivers wey dey rise; wen e waves rise go up, na you dey
cool dem down. - You don break Rahab to pieces like deadbody; you scata all your enemies—wit
your strong hand. - Na you get di heavens, na you get di earth sef. Na you make di world—plus everi-everi
wey dey inside am. - Na you make di north plus di south; Tabor and Harmon dey sing wit happiness
for your name. - Your hand strong well-well, your hand na kakaraka, your right hand get levels.
- Goodness plus justice nahin be di foundation of your king-chair; mercy plus
truth dey waka for your front. - Oh Baba-God, blessings for those pipo wey know di joyful sound! Oh Baba-God,
dem go waka for di light wey dey shine for your front. - From morning till night nahin dem dey happy for your name, and your goodness go
carry dem up. - Na you be di levels of dia strength, and by your favour awa horn don raise go up.
- Baba-God na awa defense, and di Holy One of Israel nahin be awa Oba.
- One time like dat, for inside vision, you follow your pipo tok sey, “I don give epp to
one pawaful pesin, I don give levels to one pesin wey I choose from di pipo. - I don see David my servant; I don anoint am wit my holy ororo.
- My hand go give am pawa; true-true my hand go make am strong.
- No enemy go fit oppress am, no wicked man go fit press am down.
- I go beat hin enemies down for hin front, and I go scata di pipo wey hate am.
- My faithfulness and my mercy go dey wit am, and wit my name—hin horn go get levels.
- I go make hin right hand rule di big-river, and hin right hand go control di rivers.
- He go halla me, ‘Na you be my Papa, my God, and di rock wey dey save me.’
- I go choose am as my firstborn sef, as di king wey get levels pass for earth.
- My mercy go keep am forever, and my agreement go stand strong wit am forever.
- I go stand hin pikin-pikin-pikin forever, and hin king-chair go dey as long as di heaven dey forever.
- “If hin pikin fashi my law, and if dem no gree follow wetin I tell dem to do,
- If dem break my law, and no gree keep my commandment,
- I go punish dia sins wit iron, and use koboko flog dem for dia wrong tins;
- but I no go carry my soft-love komot from am kpatakpata, or allow my
faithfulness fail. - I no go break my agreement or change mouth.
- Once and for all, I don swear wit my holiness—and I no go lie to David
- sey hin pikin-pikin-pikin go kontinu forever, and sey hin king-chair go be like di
sun for my front. - Di king-chair go stand gidigbam forever like di moon—even like my faithful witness
for sky.” - But you don fashi me, you don reject me, and you dey vex for di pesin wey you don
anoint. - You don reject di agreement wey you make wit your servant, and you don spoil hin
crown—con put am for sand-sand. - You don break all hin wall, con scata hin strong-house.
- Everi-pesin wey dey pass—dey steal di tins wey he get, and hin neighbours dey use
am laff. - You don give levels to hin enemies right hand; you don mak all hin enemies dey
happy. - You don turn your sword face back, and you no gree support am for fight.
- You don fall all hin levels, con put hin king-chair for sand-sand.
- You don cut di days of hin youth short; con cover am wit shame.
- How long Baba-God—wey you go dey hide yoursef forever? How long your vex go
burn like faya? - Remember as my life short reach, abi you make man pikin for notin?
- Which man dey alive wey no go kpeme? Abi he fit save hin life from di pawa of
grave? - Oh Baba-God, where di soft- love wey you bin swear to David inside your truth?
- Oh Baba-God, no forget di disgrace wey your servants dey face, see as I take dey carry
di insult of all di plenty pipo for my heart, - di insult wey your enemies don take yab everi step of di pesin wey you anoint, chai
Baba-God. - Praise be to Baba-God forever! Amen