Psalm Chapter 89

Abeg share
  1. I go sing about Baba-God ogbonge love forever, wit my mouth go yarn about
    Baba-God faithfulness for all di generations.
  2. I go ok sey your love dey stand gidigam forever, sey you don stand your
    faithfulness gidigbam for ground inside heaven.
  3. You sey, “I don make convenant wit di one wey I choose, I don swear give David
    my servant sey,
  4. ‘Dem your pikin go stand gidigbam for ground forever and I go con make yout
    throne stand for ground gidigbam for all generations.”
  5. O Lord, di heavens dey praise your wonders and your faithfulness for where di
    holy-pipo gather put.
  6. Who dey for di sky wey fit compare wit Baba-God? Who be like Baba-God for
    among di pipo of heaven?
  7. Dem dey fear God well-well among di senior-men for heaven. He ogonge pass
    all of dem wey dey hin side.
  8. O Lord God Almighty, who fit be like you? You big well-well and your
    faithfulness full your side.
  9. Na you dey control the seas wey dey pour come out; wen hin waves rise go up,
    na you dey cool am down.
  10. You nack Rahab for ground like deadbody; you dabaru all you enemies wit
    your strong hand.
  11. Na you get di heaven, na you get di earth sef. Na you create di world plus
    everi-everi wey dey inside am.
  12. Na you create di north and di south; Tabor and Harmon dey sing wit joy for
    your name.
  13. Na power dey your arm, your hand dey strong, your right hand get levels.
  14. Righteousness and justice na di foundations of your throne; love and
    faithfulness dey waka for your front.
  15. Oh Lord, blessed na those pipo wey don learn sey dem belong to you, wey dey
    waka for di light wey dey shine for your front.
  16. From morning till night nahin dem dey happy for your name, dem praise you
    for inside your righteousness.
  17. Na you be dia levels and dia strength and you use your favor give dia horn
    levels.
  18. Awa king, the holy one of Israel, true-true, na you get our shield.
  19. Dat year for inside vision, you follow your pipo yarn sey, “I don pack strenght
    full on fighter fight body; I don give one young man levels among di pipo.
  20. I don see David my servant; I don anoint am wit my holy ororo.
  21. My hand go keep am; true-true my hand go give am strength.
  22. No enemy go fit make am pay homage, no wicked man go fit press am down.
  23. I go nack hin enemies down for hin front and I go strike hin enemies down.
  24. My faithful love go dey wit am, and wit my name hin horn go get levels.
  25. I go put hin hand cover di sea and hin right hand go cover di rivers.
  26. He go halla me, ‘Na you be my Palee, my God, my rock and savior.’
  27. I go make am be my firstborn sef, di king wey get levels pass for dis earth.
  28. I go maintain my love for am forever, and my agreement wit am no go ever
    fail.
  29. I go stand dem hin pikin gidigbam for di land forever, and hin throne go dey as
    long as di heaven dey forever.
  30. “If dem hin pikin fashi my law an dem no gree follow my way,
  31. If dem go gree do wetin I talk sey make dem do and no gree keep my
    commandment,
  32. I go use iron punish dia sins and use koboko flog dem for dia bad-bad sins;
  33. but I no go carry my love comot from am, or make I ever betray hin
    faithfulness.
  34. I no go break my agreement or change mouth.
  35. Once and for all, I don swear wit my holy-holy way—and I no go lie to David—
  36. sey dem hin pikin-pikin go carry-go forever and hin throne do dey for my front
    like di sun;
  37. e go stand gidigbam forever like di moon. Di faithful witness for sky.”
  38. But you don bone me, you don fashi, you don dey vex for di one wey you don
    anoint.
  39. You don fashi di agreement wey you make wit your servant and you don make
    hin crown rub dust for ground.
  40. You don brake all hin wall, con scata where he dey hide hin head put.
  41. Everi-pesin wey dey pass dey steal di tins wey he get. Hin neighbours dey use
    am laff.
  42. You don give hin enemies right hand levels; you don make all hin enemies dey
    happy.
  43. You don turn your sword face anoda side and you no gree support am for
    fight.
  44. You don stop all hin beta-beta life con put hin throne for ground.
  45. You don cut di days of hin youth short; con make shame full hin life.
  46. How long, Oh Baba-God, you go dey hide yourself forever? How long you go
    dey vex like faya.
  47. Remember as my life take dey kiakia pass go, wetin you gain by creating men!
  48. Which man fit dey wey no go die? Or fit save hinself from grave?
  49. Oh Baba-God, where di ogbonge love wey you bin get for us before-before,
    wey you bin swear give David wit your faithfulness?
  50. No forget, Oh Baba-God, as pipo don yab your servant reach, as I take dey
    maintain for my heart as di nations dey whyne me.
  51. Di whyning wey dem your enemies take yab everi step of your anointed pesin.
  52. Prasise be to Baba-God forever! Amen and Amen.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *