Psalm Chapter 119

Abeg share

Baba-God Law (Aleph)

  1. Blessings for those pipo wey dia way no get error, wey dey waka based-on Baba-God law.

2. Blessings for those wey dey keep Baba-God commandment, wey dey fyne am wit all dia heart.

3. Dem no dey do wrong tin; dem dey waka for hin way!

4. You don command us to keep your law wit seriousness.

5. Oh, I wish sey na you dey direct me to keep your laws!

6. So shame no go catch me wen I dey reason all your commandments.

7. I go praise you wit clean-heart, as I dey learn your good judgements.

8. I go obey your law; no fashi me kpatakpata.

Beth

9. How young pesin fit take keep hin way pure? Na by living hin life based-on your word.

10. I dey fyne you wit all my heart; no let me waka komot from your way.

11. I don hide your word inside my heart—sey I no go sin against you.

12. Blessings for you, oh Baba-God; teach me your laws.

13. Wit my lips—I don tok all di laws wey you give us from your mouth.

14. I don jolly inside di way of your yarnings—like pesin wey get moni well-well.

15. I go meditate on your teaching, and I go reason your ways.

16. Body dey sweet me for your laws; I no go fashi your words.

Gimel

17. Do good to your servant, and I go live, con obey your word.

18. Open my eyes so dat I go see di ogbonge tin wey dey inside your teaching.

19. I be stranger [jjc] for dis earth; no hide your commandments from me.

20. My soul really want your judgement well-well everi time.

21. You change-am-for pipo wey dey feel-big—wey curse dey for dia head, and wey dey waka komot from your way.

22. No let dem laff me or yab me—becos I dey follow your way.

23. Even though rulers sidon—con dey bad-mouth me, your servant go meditate on your word.

24. Your word dey tortori me; na dem dey give me beta advice.

25. My soul dey for dust; ginger my life based-on your word.

26. I don tell you about my plans and you ansa me; teach me your word.

27. Epp me understand di way of your word; so dat I go meditate on your ogbonge work.

28. My soul don taya for cry-cry; give me strength based-on your word.

29. Carry lie-lie way komot from my side, and give me your law wit grace.

30. I don choose di way of truth; I don put your word for my front.

31. I dey hold your word tight. Chai Baba-God, no let shame catch me.

32. I go waka inside di way of your law, becos you go open my heart to understand.

He

33. Oh Baba-God, teach me to follow your word; and I go follow your word reach di end.

34. Give me understanding so dat I go keep your word; true-true, I go observe am wit my whole heart.

35. Make me waka inside di way of your commandment, na there my happiness dey.

36. Turn my heart go face your word, instead of me to get ojukokoro.

37. Turn my heart komot from yeye tins, and ginger me inside your way.

38. Do wetin you promise to your servant wey dey fear you seriously.

39. Carry di disgrace wey I dey fear komot, becos your judgement dey good.

40. See as I dey fyne your way! Ginger me inside your goodness.

Waw

41. Oh Baba-God, make your mercies come meet me, plus your salvation based-on your promise;

42. so I go fit ansa any-pesin wey dey yab me, becos I trust in your word.

43. No ever komot di word of truth from my mouth, becos I don put my hope inside your word.

44. I go always obey your word for ever and ever.

45. I go waka upandan wit freedom, becos I dey fyne your way.

46. I go tok about your word for front of kings, and shame no go catch me.

47. Baba-God, I dey happy inside your word—wey I love.

48. I go carry my hand up to your commandment wey I love; and I go meditate on your laws.

Zayin

49. Remember your promise to me—your servant, wey you don make me put hope on.

50. Wetin dey cool me down inside my suffer-head nahin be dis: your word dey give me life.

51. Pipo wey dey feel-big dey yab me taya, but I no turn komot from your word.

52. I remember your laws from olden days, oh Baba-God, and dem don cool me down.

53. I con dey vex for wicked pipo well-well—becos dem don fashi your way.

54. Your laws nahin be my song any where I stay—on di road to my holy destiny.

55. Oh Baba-God, I remember your name for night, and I keep your law.

56. Na dis tin I dey do since: I dey obey your commandments.

Heth

57. Oh Baba-God—you be everitin wey I want, I don promise to obey your words!

58. I don fyne your face wit all my heart; sorry-for me—based-on your promise.

59. I reason my ways, and I don turn my leg to follow your word.

60. I do fast-fast, I no go waste time to obey your word.

61. Even though badbelle pipo use rope tie me, I no go fashi your law.

62. For midnight, I go wake up to give you tanks for your good judgements [laws].

63. Everi-pesin wey dey fear you na my padi, and everi-pesin wey dey follow your law na my padi.

64. Di earth brekete wit your love, oh Baba-God; teach me your laws.

65. Oh Baba-God, you don do good to your servant, based-on your word.

66. Teach me knowledge and beta judgement, becos I trust your commands.

67. Before, suffer-suffer hook me, and I waka komot from your way, but now I dey obey your word.

68. You dey good, and you dey do beta tins; teach me your laws.

69. Even though pipo wey dey feel-big dey stain me wit lie, I go keep your law wit all my heart.

70. Dia heart heavy like ororbor, but your law dey make body sweet me.

71. E good as suffer-suffer hook me, so dat I go fit learn your laws.

72. Di laws from your mouth make sense to me pass thousands of gold coins plus silver.

Yod

73. Your hand nahin make me, and nahin form me; give me understanding to learn your commandments.

74. Make those pipo wey dey fear you—happy wen dem see me, becos I don put my hope inside your word.

75. Oh Baba-God, I know sey your laws dey right, and you don suffer me inside your faithfulness.

76. I pray make your kind mercies cool me down, just as you don promise your servant.

77. Show me your soft-heart so dat I go live, becos your law dey make body sweet me.

78. Make shame catch pipo wey dey carry-shoulder, becos dem do me ojoro for no reason; but I go meditate on your law.

79. Make those pipo wey dey fear you—turn face me, those pipo wey sabi your word.

80. Make my heart no get any error for your ways, so dat shame no go catch me.

Kaph

81. My soul dey faint as I dey fyne your salvation, but I dey put my hope inside your word.

82. My eyes wan close as I dey fyne your word; I tok sey, “Wen you go cool me down?”

83. Even though I don be like bottle for inside smoke, but I no fashi your law.

84. How long your servant go dey wait? Wen you go punish pipo wey dey show me pepper?

85. Those pipo wey dey carry shoulder don dig hole for me-pipo wey no dey follow your law.

86. I fit trust all your command; epp me, men dey show me pepper for no reason.

87. Dem almost sweep me komot from di earth, but I neva fashi your laws.

88. Ginger me based-on your soft- love, so dat I go obey di law of your mouth.

Lamed

89. Forever, oh Baba-God, your word dey settled for heaven.

90. Your faithfulness dey last for all generations; you build di earth and e stand gidigbam.

91. Your laws don last reach today, everitin dey serve you.

92. If to sey no be your laws dey make body sweet me, I for don kpeme inside my suffer-head.

93. I no go ever forget your law, na dem you use take give me life.

94. Save me, I belong to you, becos I don fyne your commandment.

95. Evil pipo dey wait to scata me, but I go reason your words.

96. Comma still dey inside everitin wey dey perfect, but your commands no get full stop.

Mem

97. Oh, see as I love your law! I dey reason am from morning till night.

98. Tru your words, you dey make me wise pass my enemies, your words dey wit me forever.

99. I get understanding pass all my teachers—becos I dey reason on your word.

100. I get more understanding pass di senior-men, becos I dey obey your laws.

101. I don komot my leg from everi evil way—so dat I go obey your word.

102. I neva waka komot from your laws; yousef don teach me.

103. See as your words dey taste sweet, e sweet pass honey for my mouth!

104. I dey gain understanding from your law; so I hate everi wrong way.

Nun

105. Your words na lamp for my leg and light for my way.

106. I don swear, con confam sey—I go follow your good laws.

107. I don suffer well-well; keep my life, Oh Baba-God— based-on your word.

108. Oh Baba-God, biko, accept di offering of praise wey dey come from my belle, and teach me your laws.

109. Even though my life always dey in danger, but I no go fashi your law.

110. Wicked pipo don set trap for me, but I neva waka komot from your ways.

111. I don inherit your laws forever; na dem dey give my heart joy.

112. I don make up my mind to keep your laws forever to di end.

113. I hate pipo wey get two-mind, but I love your law.

114. Na you I dey hide my head put, and na you dey guard me; I dey put my hope on your word.

115. Badbelle pipo, oya komot for where I dey, becos I go keep Baba-God law!

116. Keep me as you don promise and I go live; no let shame catch me becos of my hope.

117. Carry me up, and I go dey saved; and I go always respect your laws.

118. You don fashi all those pipo wey waka komot from your way, dia wuru-wuru na fake.

119. You don fashi all di wicked pipo for di earth like yama-yama, so I love your laws.

120. My body dey shake becos I dey fear you; and I dey fear your judgements.

121. I don do justice and goodness, no leave me wit pipo wey dey oppress me.

122. Make sure sey your servant dey alright; no let pipo wey dey make-mouth oppress me.

123. My eyes don dey pain me as I dey fyne your salvation, as I dey fyne your correct word.

124. Run tins wit your servant based-on how you dey sorry-for pesin, and teach me your laws.

125. I be your servant, give me understanding so dat I go sabi your words.

126. Oh Baba-God, e don reach time wey you go do sometin; becos dem dey break your laws.

127. True-true, I love your command pass gold—eehn, pass pure gold.

128. So I reason sey all your laws about everitin dey right for me to follow, I hate everi wrong way.

Pe

129. Your words dey make me wonder; so my soul dey obey dem.

130. As your word dey enta—e dey show light; e dey make ordinary pipo sabi understand.

131. I open my mouth dey breath- fast fast, becos I dey fyne your word.

132. Turn face my side, con sorry-for me, as you dey do to pipo wey love your name.

133. Direct my leg based-on your word; no let sin control my life.

134. Save me from di oppression of man, so dat I go obey your word.

135. Make your face shine for your servant body, and teach me your laws.

136. Water dey rush down from my eyes like river, becos pipo no dey obey your law.

Tsadde

137. Oh Baba-God, you dey good, and your judgements dey right.

138., Di laws wey you don put down na correct law; and dem faithful wella.

139. I don taya to dey burn like faya, becos my enemies don fashi your word.

140. Your word pure wella, so your servant love dem.

141. Even though my level low, and pipo hate me, I no forget your teaching.

142. Your goodness dey last forever, and your word na true.

143. Wahala and serious pain don cover my head, but na your laws dey tortori me.

144. Your words dey correct forever; give me understanding so dat I go live.

Qoph

145. I dey call wit all my heart; ansa me, oh Baba-God, and I go obey your laws.

146. I dey cry to you, save me and I go keep your word.

147. I wake up before morning reach, and I dey cry for epp; I dey put my hope on your word.

148. My eyes dey open tru-out di night, so dat I fit reason your promises.

149. Hear my voice based-on your soft love; oh Baba-God, ginger my life based-on your justice.

150. Those pipo wey dey plan wicked tins don dey near me; but dem dey far from your law.

151. But you dey near, oh Baba-God, and all your laws na real.

152. E don tey wey I don know sey you don stand your word to last forever.

Resh

153. Look my suffer-suffer and make you free me, becos I neva fashi your law.

154. Fight for me and save me; keep my life based-on your promise.

155. Salvation dey far from wicked pipo, becos dem no gree fyne your laws.

156. Oh Baba-God, your soft mercy burku wella; ginger my life based-on your judgement.

157. Plenty pipo dey show me pepper and my enemies burku, but I no turn komot from your word.

158. Yeye dey smell as I dey look evil pipo, becos dem no gree obey your word.

159. See as I love your word; oh Baba God ginger my life based-on your love.

160. All your words na true; and all your good laws dey last forever.

Sin and Shin

161. Pipo wey get pawa dey show me pepper for no reason, but my heart dey wonder for your word.

162.

I dey happy for your word, like

pesin wey see beta-beta-tins.

163. I hate, and I no like lie-lie, but I love your word.

164. I dey praise you seven times a day—becos of your correct judgement.

165. Pipo wey love your word—get peace well-well, and notin fit make dem stagger.

166. Oh Baba-God, I dey wait for you to save me, and I dey do wetin you tell me to do.

167. My soul dey keep your word, and I Mlove dem wella.

168. I dey obey your teachings, plus your word—and you sabi all my ways.

Tau

169. Oh Baba-God, listen to my cry; give me understanding based- on your word.

170. Listen to wetin I dey ask for; free me—based-on your word.

171. Make my lips pour wit praise, becos you dey teach me your laws.

172. My tongue go tok about your word, becos everitin wey you tell me to do—na di right tin.

173. Use your hand take epp me, becos I don choose your teachings.

174. Oh Baba-God, I dey wish for your salvation, and your law dey tortori me.

175. Make my soul live, and I go praise you, and make your word epp me.

176. I don miss-road like sheep wey lose. Fyne your servant becos I no dey fashi your commands.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *