Psalm Chapter 118

Abeg share

Tanks-giving

  1. Give tanks to Baba-God becos he dey good, and he dey sorry-for pesin forever.

2. Make Israel tok sey: “He dey sorry for pesin forever.”

3. Make di house of Aaron tok sey, “He dey sorry-for pesin forever.”

4. Make di pipo wey dey fear Baba-God tok sey, “He dey sorry-for pesin forever.”

5. I cry to Baba-God for inside my palava—and he ansa me, he free me—con put me for big space.

6. Baba-God dey wit me, I no go fear. Wetin men fit do me?

7. Baba-God dey wit me, nahin dey epp me; so I go see my wish upon babelle pipo.

8. E beta to trust Baba-God, dan to trust human being.

9. E beta to trust Baba-God, dan to trust pipo wey get pawa.

10. All di nations gada round me, but I scata dem wit Baba-God name.

11. Dem surround me for everi corner, but I scata dem wit Baba-God name.

12. Dem gada me round like bees, but dem quench like shuku-shuku wey dey burn; I go scata dem wit Baba-God name.

13. You push me hard—so dat I go fall, but Baba-God epp me.

14. Baba-God na my strength and my song; nahin be my salvation.

15. Songs of joy and salvation dey for di house of good pipo: Baba-God right hand don do strong tins.

16. Baba-God right hand dey for up-up; Baba-God right hand don do strong tins.

17. I no go kpeme, but I go live, and I go tok about Baba-God handwork.

18. Baba-God don discipline me wella, but he no gree let me kpeme.

19. Open di gate of goodness for me; I go enta con give praise to Baba-God.

20. Dis na di gate of Baba-God wey good pipo go pass enta.

21. I go give you tanks becos you ansa me; na you dy save me.

22. Di stone wey di builder fashi, don turn to di chief foundation stone,

23. Baba-God don do am, and e surprise awa eyes.

24. Dis na di day wey Baba-God don make; we go jolly con happy inside am.

25. Oh Baba-God, I pray, save us now. Oh Baba-God, prosper us.

26. Blessings for di pesin wey dey come wit Baba-God name. We don bless you from Baba-God house.

27. Baba-God na Oga, and he don give us light; tie di sacrifice wit ropes to di horn of di altar.

28. Na you be my God and I go praise you; you be my God and I go cut-cap for you.

29. Oh make una give tanks to Baba-God becos he dey good; and he dey sorry-for pesin forever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

⭐ Abi you dey enjoy di Pidgin Bible?

If dis app dey bless you, abeg rate us con write small review for Google Play. Your support dey epp more pipo discover Baba-God Word.

★★★★★
Share Pidgin Bible App