Proverbs Chapter 10

Abeg share

Solomon Proverbs: Wise Pikin

  1. Proverbs of Solomon: Wise pikin dey give
    hin papa joy, but mumu pikin dey make hin
    mama sad.
  2. Property wey pesin obtain—na waste, but
    clean-hands dey save pesin from death.
  3. Baba-God no go let hungry beat good
    man, but he dey dabaru badbelle pipo wish.
  4. Lazy hands dey make man poor, but hand
    wey dey do business dey bring moni.
  5. Any-pesin wey dey work hard for harvest
    season—na wise pikin, but pesin wey dey
    sleep for harvest na pikin wey dey bring
    disgrace.
  6. Blessings na crown for good pesin head,
    but fight- fight nahin full badbelle pipo
    mouth.
  7. Di memory of good pesin na blessings, but
    di name of badbelle pipo go fade.
  8. Pesin wey wise for hin heart go receive
    teaching, but mugu wey dey tok-tok go fall.
  9. Pesin wey get clean- heart dey waka wit
    safety, but dem go catch pesin wey hin way
    get k- leg.
  10. Pesin wey dey look pesin wit bad-eyes
    dey cos wahala, and mumu pesin wey dey
    miss-yarn go fall.
  11. Good pesin mouth na well of life, but
    fight-fight nahin cover evil pesin mouth.
  12. Hatred dey ginger quarrel, but love dey
    cover all wrong tins.
  13. Wisdom dey for di lips of pipo wey get
    understanding, but koboko nahin good for
    mumu pesin back.
  14. Wise men dey gada knowledge, but mumu pesin mouth no far from scata-scata.
  15. Bigman moni dey for hin strong city,
    but poverty of poor pipo nahin dey kill dem.
  16. Good man hustle dey bring am life, but
    badbelle pesin salary na sin.
  17. Pesin wey dey accept discipline, dey
    waka for di way of life, but any-pesin wey no
    wan gree accept correction—go waka miss-
    road.
  18. Lie-lie full di lips of any-pesin wey carry
    pesin for mind, and any-pesin wey dey do
    tatafo na mugu.
  19. Plenty tok dey bring sin, but any-pesin
    wey hold hin tongue na wise pesin.
  20. Good man tongue na fine silver, but
    badbelle pesin heart na gbanjo.
  21. Good man lips dey feed plenty pipo, but
    mugu dey kpeme becos dem no get-sense.
  22. Baba-God blessings dey bring wealth
    wit-out sadness.
  23. To do evil tin be like sport for mugu, but
    man wey get understanding get wisdom.
  24. Wetin wicked man dey fear nahin go kill
    am las-las; wetin righteous pesin really
    want—nahin he go get.
  25. Afta rolling-breeze don sweep go,
    badbelle pipo sef go follow am go, but good
    m a n get ever lasting foundation.
  26. As sawa drink be for teeth, and as smoke
    be for eyes, naso lazy man sef be—to di pipo
    wey send am.
  27. If you respect Baba-God, you go live
    long, but badbelle pipo life no dey last.
  28. Good man hope dey bring happiness, but
    wicked man hope go kpeme.
  29. Baba-God way na pawa for pipo wey get
    clean- heart, but scata-scata na di destiny of
    pipo wey dey do evil tins.
  30. Good man root no go fit ever komot from
    ground, but badbelle pipo no go stay for dis
    earth.
  31. Good man mouth dey bring wisdom, but
    corrupt tongue go cut komot.
  32. Good pesin lips dey tok beta tin, but na
    only bend-bend tok nahin dey for wicked
    man mouth.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *