Proverbs Chapter 14
Women Wey Get-sense Dey Build
Dia House
- Wise woman dey build her house, but
mumu woman go use her own hand take
scata her house. - Pesin wey get clean- heart dey fear Baba-
God, but pesin wey dey corrupt —hate Baba-
God. - Swegbe dey make- mouth and dem go flog
am koboko, but wise man lips dey protect
am. - Where malu no dey, di container for malu
food go clean, but di pawa of malu dey bring
plenty harvest. - Faithful witness no dey tok lie, but fake
witness dey tok lie. - Swegbe dey fyne wisdom and he no see
am, but knowledge easy for pesin wey get
understanding. - Komot for where mumu man dey, wen you
no-fit learn anytin from hin lips. - Di wisdom of pesin wey get-sense na to
understand hin way, but di kolomentality of
mugu na to dey whyne hinsef. - Mumu pipo dey laff instead of dem to
change, but alubarika (blessings) dey for
where good pipo dey. - Na you know where dey pain you, and
no-pesin fit share inside your happiness. - Wicked man house go scata, but good
man house go prosper. - E get one way wey be like sey e dey right
for man, but las-las di way dey lead to death. - Pesin fit dey laff, but he dey cry inside
hin heart, and celebration fit end wit cry-cry. - Badbelle pipo go reap wetin dem sow
based-on dia way of life, and good man go
get hin blessings from Baba-God. - Swegbe dey believe anytin wey dem tell
am, but pesin wey get-sense dey reason hin
way. - Wise man dey fear and he dey komot hand from evil, but mumu pesin dey para and hin blood dey hot.
- Pesin wey dey quick vex dey do mumu
tins, and pipo hate pesin wey dey do mago-
mago. - Ode (mumu) go inherit kolomentality, but
pesin wey get- sense go wear crown of
knowledge. - Evil men go bow down for good men
front, and badbelle pipo go bow down for
good men gate. - Even poor man neighbour hate am, but
bigman get plenty padi. - Pesin wey hate hin neighbour don
commit sin, but happiness dey for di pesin
wey dey sorry-for poor pipo. - Abi pipo wey dey plan bad tins no dey
waka miss-road? But mercy plus truth belong
to pipo wey dey plan good tins. - All hard work dey bring profit, but tok-
tok dey make pesin poor! - Wise man wealth na hin crown, but di
kolomentality of mugu na yeye. - Witness wey dey tok true dey save life,
but witness wey dey lie—na wayo. - Pesin dey get full-mind wen e dey fear
Baba-God, and dia pikin sef go get place to
hide dia head. - Di fear of Baba-God na water of life wey
dey flow, to komot man from trap of death. - Plenty population na king levels, but
prince dey fall wit- out plenty followers. - Man wey no dey quick vex get beta
understanding, but pesin wey dey quick vex
dey show di high level of hin mumu. - Heart wey get peace na good health, but
jealousy dey spoil pesin bone. - Pesin wey dey oppress poor pipo dey
disrespect who make am, but pesin wey dey
respect Baba-God, dey sorry-for poor pipo. - Dem go pursue wicked man komot inside
hin wickedness, but good man get place to
hide hin head—even wen death show. - Wisdom dey rest for inside di heart of
those pipo wey get understanding, but wetin
dey inside mumu pipo heart go show. - Goodness [righteousness] dey give
nation levels, but sin na disgrace to any pipo. - King dey favour servant wey wise, but
he dey vex for servant wey dey bring
disgrace.
Questions about Proverbs 14
What is Proverbs 14 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 14 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-14/
Where can I read Proverbs 14 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 14 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-14/
Which Bible book contains Proverbs 14?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 14?
The chapter identified by this reference is 14.
Topics connected to this passage
- Faith
- Salvation
- Forgiveness
- Peace
- Wisdom
- Fear
- Money
- Healing
- Guidance