Proverbs Chapter 15
Soft Ansa Dey Stop Vex
- Simple ansa go make pesin wey dey
vex—cool down, but harsh words dey make
pesin para. - Wise man tongue sabi use wetin he know
well-well, but na yama-yama nahin dey pour
komot for mumu pesin mouth. - Baba-God eyes dey look everi-where, he
dey watch both good, plus bad pipo. - Soft word na tree of life, but wayo mouth
dey spoil pesin spirit. - Mumu pipo dey fashi wetin dia papa teach
dem, but any- pesin wey hear correction get-
sense. - Good man house brekete wit beta-beta-
tins, but wicked pipo salary dey bring wahala
for dem. - Wise man lips dey spread knowledge; but
mumu pesin heart no-fit spread any beta tin. - Di sacrifice of wicked na tufiakwa for
Baba-God, but good man prayer dey make
belle sweet. - Wicked man way na tufiakwa for Baba-
God, but he love those pipo wey dey follow
goodness. - Serious punishment dey wait for any-
pesin wey waka komot from beta way, and
pesin wey hate correction go kpeme. - Death and scata-scata dey for Baba-God
front—tokless of men heart! - Mumu pesin hate make pesin dey correct
am; he no go gree go meet wise man to learn. - Heart wey dey happy dey make face
shine, but heart wey dey feel sad dey weak
spirit. - Di heart of man wey get understanding—dey fyne knowledge, but
yeye nahin mugu dey chop. - All di days of di life of di pipo wey dem
dey oppress—na evil, but heart wey dey
happy dey always flex. - E beta make you get small tin con dey
respect Baba-God, dan make you get plenty
wealth—wit plenty suffer-head. - E beta make you dey chop vegetables for
where love dey, dan make you dey chop fat
malu for where hate dey. - Pesin wey like to vex dey cause fight, but
jeje man dey make kwanta cool down. - Na shuku-shuku full lazy man way, but
good man way na express way. - Wise pikin dey make hin papa happy, but
mumu man dey fashi hin mama. - Yeye dey make ode happy, but man wey get understanding dey go hin own straight way.
- Plan dey fail becos beta advice no dey, but
pesin go succeed wit many advisers. - Man dey happy wen he ansa pesin
well—and word wey pesin tok for di right
time dey make-sense well! - Di way of life na up-up for wise man—to
save am from di grave. - Baba-God go scata di house of pipo wey
dey feel-big, but he go keep di widow land. - Di tinking of wicked man na tufiakwa for
Baba-God, but pure words dey sweet. - Man wey get ojukokoro dey carry wahala
go meet hin family, but pesin wey hate egunje
(bribe) go live. - Good man heart dey reason wetin he go
ansa pesin, but wicked man heart dey pour
evil come out. - Baba-God dey far from evil pipo, but he
dey hear good pesin prayer. - Pesin wey look happy dey give heart joy,
and good news dey give good health to di
bones. - Pesin wey dey listen to di correction of
life—go dey among wise pipo. - Pesin wey hate teaching—hate hin own
soul, but any-pesin wey listen to correction
go gain understanding. - Di fear of Baba-God na di teaching of
wisdom, and pesin must humble before e get
promotion.
Questions about Proverbs 15
What is Proverbs 15 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 15 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-15/
Where can I read Proverbs 15 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 15 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-15/
Which Bible book contains Proverbs 15?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 15?
The chapter identified by this reference is 15.
Topics connected to this passage
- Love
- Hope
- Prayer
- Wisdom
- Fear
- Family
- Healing
- Guidance