Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 16

    Asa Agreement Wit Syria Hanani Message to Asa 7. Around dat time, Hanani di prophet visit King Asa of Judah, con tell am sey: “Becos you hope on di king of Syria and you no put your hope on Baba-God wey be your Oga, so di army of di king of Syria don escape from your hand. 8. Abi di Ethiopians plus di Libyans bin no get big army wit plenty horse-moto and plenty-plenty horse-riders? But wen you trust Baba-God, he put dem for your hand! 9. Surely, Baba-God dey look upandan di whole earth, and he dey ready to show hin pawa to those pipo wey dey follow am. You don do mumu tin for  dis mata; from now on na war you go dey fight. 10. So Asa vex for di prophet well-well, sote he put am inside prison. He para for am becos of dis tins. Asa still oppress some of di pipo dat time. As Asa Take Sick, Con Kpeme 11. Di tins wey happun wen Asa be king, from starting to di ending, dem write dem for di Books of di Kings of Judah plus Israel. 12. For di thirty-ninth year wen Asa be…