Blog
Your blog category
-
Exodus Chapter 1
PharaohMake Dem Suffer 7. Di pikin of Israel con dey prosper, and dem grow well-well, con dey strong; so dem plenty for di land. 8. New king con dey Egypt wey no know Joseph. 9. Naso di king tell hin pipo sey, “See, di pipo of Israel don plenty pass us, and dem don dey stong pass us. 10. Come make we use sense follow dem run tins, or dem go too plenty, and if e con happun sey war dey, dem fit join awa enemies, con fight against us, con komot from di land. 11. So dem put dem under pipo wey go dey punish dem wit hard work.…
-
Exodus Chapter 2
Dem Born Moses Moses Jakpa [Run] 11. E happun sey for those days, wen Moses don grow, he komot go see hin pipo, he con see dia suffer-head. He see one Egyptian dey beat one Hebrew—one of hin pipo. 12. He con look left and right and wen he see sey no pesin dey for there, he kill di Egyptian, con hide am for sand-sand. 13. Naso he komot di second day, con see two Hebrew men dey fight demsef. So he tell di one wey dey don do wrong tin—sey, “Why you dey fight your broda?” 14. He con tok sey, “Who make you judge and prince for…