Blog
Your blog category
-
Psalm Chapter 99
-
Psalm Chapter 100
Dis Na Hymn Of Praise 1. Dis na Psalm of tanks-giving. Make una shout wit happiness to Baba-God, all di earth. 2. Make una jolly dey serve Baba-God; carry songs of happiness come meet am. 3. Make una know sey Baba-God na Oga. Nahin make us, and no be we make awasef. We be hin pipo—di sheep of hin farm. 4. Enta hin gate wit tanks-giving and hin house wit praises; give tanks to Baba-God con bless hin name. 5. Baba-God dey good, and he dey sorry-for pesin forever; and hin truth dey last for all generations.