Psalm Chapter 99
- Baba-God dey reign, make di nations dey shake; he sidon for throne for middle
of cherubim, make di earth shake. - Baba-God na ogbonge for Zion; he get levels pass all di nations.
- Make dem praise you ogobge and elele name—he dey holy.
- Di king dey mighty and he love justice—you don stand your justice gidigbam;
for Jacob, you don do wetin dey fair and right. - Make una cut-cap for Baba-God wey be awa Oga and make una worship for hin
footstool; he dey holy. - Moses and Aaron dey among hin priest, Samuel dey among those pipo wey call
hin name; dem call Baba-God and he ansa dem. - He follow dem tok from di pillar of cloud; dem keep hin law and di
commandment wey he give dem. - Oh Baba-God wey be awa Oga, you ansa dem, you be God wey dey forgive
Israel, even though you punish dem for di bad tins wey dem do. - Make una cut-cap for Baba-God wey be awa Oga, con worhip for hin holy
mountain, Baba-God wey be awa Oga dey holy.
Questions about Psalm 99
What is Psalm 99 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 99 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-99/
Where can I read Psalm 99 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 99 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-99/
Which Bible book contains Psalm 99?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 99?
The chapter identified by this reference is 99.
Topics connected to this passage
- Love
- Worship