Blog
Your blog category
-
Psalm Chapter 101
Di Promise Of David 1. Dis na Psalm of David. I go sing about your mercy plus justice; Oh Baba-God, na to you I go sing praises. 2. I go live beta life in a perfect way—wen you go come meet me? I go waka for my house wit clean-heart. 3. I no go use my eye look any evil tin. I hate di works of pipo wey don turn komot from Baba-God; e no go gum-join me. 4. Men wey get bend-bend heart go komot from my side; I no go know evil tins. 5. I go scata any-pesin wey bad-mouth hin neighbour for secret; I no go accept…
-
Psalm Chapter 102
Di Cry For Epp Of Man Wey Dey Face Wahala 1. Dis na prayer for pesin wey dey face wahala, wey don taya, and wey dey cry to Baba-God. Hear my prayer, Oh Baba-God; make my cry for epp come meet you. 2. No hide your face from me wen I dey face wahala. Turn your ears come my side; ansa me kiakia wen I call. 3. My days dey vanish like smoke; my bones dey burn like charcoal. 4. My heart dey feel pain and e don dry like grass—sote I dey forget to chop my food. 5. Becos of my loud cry, I don slim down to lekpa.…