Psalm Chapter 101

Abeg share

Di Promise Of David

1. Dis na Psalm of David. I go sing about your mercy plus justice; Oh Baba-God, na to you I go sing praises.

2. I go live beta life in a perfect way—wen you go come meet me? I go waka for my house wit clean-heart.

3. I no go use my eye look any evil tin. I hate di works of pipo wey don turn komot from Baba-God; e no go gum-join me.

4. Men wey get bend-bend heart go komot from my side; I no go know evil tins.

5. I go scata any-pesin wey bad-mouth hin neighbour for secret; I no go accept pesin wey dey look pipo wit small- eyes, and wey dey buga for dia heart.

6. I go put my eyes on di faithful pipo wey dey for di land, so dat dem go stay wit me; di ones wey waka in a perfect way– go serve me.

7. No-pesin wey dey do mago- mago go stay for my house; no- pesin wey dey tok lie go fit stand for my front.

8. For early morning, I go scata all di wicked pipo for di land, and I go komot everi-pesin wey dey do evil tins from di city of Baba-God.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now