Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 107

    Na Baba-God Dey Save Us 2. Make di pipo wey Baba-God don save tok dis tin—those wey he save from di enemies hand, 3. those pipo wey he gada from di lands, from east plus west, north and south. 4. Many of dem dey waka upandan for inside desert—dem no see road enta city wey dem fit settle put. 5. Hunger wan kill dem finish, and dem no see water to drink, dia soul con taya inside dem. 6. Naso dem con cry to Baba-God inside dia kasala, and he free dem from dia palava. 7. He carry dem pass di correct road—con enta di city wey dem fit settle…

  • Psalm Chapter 108

    Dis Na Cry For Epp 2. Wake up, harp and lyre [musical instruments]. I go wake up di sun. 3. I go cut-cap for you, Oh Baba-God, for front of di nations; I go sing about you for among di pipo. 4. Your mercy high pass heavens; and your truth reach di sky. 5. Oh Baba-God, make your levels high pass di heavens, and make your glory high pass di earth. 6. So dat di pesin wey you love go dey free—save wit your right hand, and hear me. 7. Baba-God don tok from hin holy place: “I go happy; I go divide Shechem, con measure out di valley of…