Psalm Chapter 108
Dis Na Cry For Epp
- Dis song na Psalm of David. Oh Baba-God, my heart dey kamkpe for you; I go sing and compose music wit all my soul.
2. Wake up, harp and lyre [musical instruments]. I go wake up di sun.
3. I go cut-cap for you, Oh Baba-God, for front of di nations; I go sing about you for among di pipo.
4. Your mercy high pass heavens; and your truth reach di sky.
5. Oh Baba-God, make your levels high pass di heavens, and make your glory high pass di earth.
6. So dat di pesin wey you love go dey free—save wit your right hand, and hear me.
7. Baba-God don tok from hin holy place: “I go happy; I go divide Shechem, con measure out di valley of Succoth.
8. Na me get Gilead, na me get Manasseh; Ephraim na my helmet, Judah na my staff.
9. Moab na my besin wey I dey wash hand, na for Edom I go throw my sandals put; for Philistia— I go shout wit winning voice.”
10. Who go carry me go di strong city? Who go make me win Edom?
11. No be you, oh Baba-God, wey don bone us, and you wey no gree follow awa army?
12. Give us epp from wahala, man epp dey useless.
13. Wit Baba-God we go win, he go march awa enemies put for ground.