Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 113

    Baba-God Dey Carry humble Pipo Go Up 2. Make we praise Baba-God name, from now and forever. 3. From where di sun dey rise—reach where e dey go down, make dem praise Baba-God name. 4. Baba-God high pass all di nations, and hin levels high pass di heavens! 5.Who be like Baba-God awa Oga—wey sidon for king-chair wey high, 6. wey dey look down to see di heavens plus di earth? 7. He dey raise di poor from dust, con carry pesin wey need epp from yama-yama; 8. he make dem sidon wit princes, wit princes of hin pipo. 9. He settle woman wey no fit born pikin for her…

  • Psalm Chapter 114

    Dis Na Song For Di Passover Festival 2. Judah turn to Baba-God holy- place, and Israel turn to hin Kingdom. 3. Di Red sea see dem, con jakpa. River Jordan turn go back. 4. Di mountain jump like rams, and di hills like lambs. 5. Wetin worry you, oh big-river, wey you con run? Chai Jordan, wetin make you turn back? 6. Mountains, wetin happun wey you jump like ram; and you hills—like lambs? 7. Oh earth, make you shake for Baba God front—for front of Baba-God of Jacob, 8. wey turn rock to stream, and make water flow from strong rock.