Psalm Chapter 114

Abeg share

Dis Na Song For Di Passover

Festival

  1. Wen Israel komot from Egypt, and di house of Jacob komot from foreign language,

2. Judah turn to Baba-God holy- place, and Israel turn to hin Kingdom.

3. Di Red sea see dem, con jakpa. River Jordan turn go back.

4. Di mountain jump like rams, and di hills like lambs.

5. Wetin worry you, oh big-river, wey you con run? Chai Jordan, wetin make you turn back?

6. Mountains, wetin happun wey you jump like ram; and you hills—like lambs?

7. Oh earth, make you shake for Baba God front—for front of Baba-God of Jacob,

8. wey turn rock to stream, and make water flow from strong rock.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now