Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 123

    Dis Na Prayer Of Mercy 2. As workers take dey look dia oga face, as house-girl take dey look her madam face, naso awa eyes take dey look Baba-God awa Oga—until he sorry-for us. 3. Sorry-for us, chai Baba-God, sorry-for us, becos we don endure as pipo hate us wella. 4. Awa soul burku wit di insult of pipo wey dey buga—and pipo wey dey feel-big hate us well- well.

  • Psalm Chapter 124

    Baba-God Dey Protect Hin Pipo 2. “If to sey Baba-God no bin dey for awa side wen men come fight us, 3. Naso dem for swallow us alive, wen dem dey para for us like faya; 4. di water for cover awa head, di stream for cover awa soul, 5. naso di plenty water for cover awa soul. 6. Praise be to Baba-God wey no let us be like bush-meat for dia teeth. 7. We don escape like bird from hunter trap; di trap don break, and we don free. 8. Awa epp dey for Baba-God name-wey make heaven plus earth.