Psalm Chapter 124

Abeg share

Baba-God Dey Protect Hin Pipo

  1. Dis na song of rising. Of David. “If to sey Baba-God no bin dey for awa side,” make Israel tok sey—

2. “If to sey Baba-God no bin dey for awa side wen men come fight us,

3. Naso dem for swallow us alive, wen dem dey para for us like faya;

4. di water for cover awa head, di stream for cover awa soul,

5. naso di plenty water for cover awa soul.

6. Praise be to Baba-God wey no let us be like bush-meat for dia teeth.

7. We don escape like bird from hunter trap; di trap don break, and we don free.

8. Awa epp dey for Baba-God name-wey make heaven plus earth.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now