Blog
Your blog category
-
Psalm Chapter 127
Prosperity Na From Baba-God 1. Dis na song of rising. Of Solomon. Unless Baba-God build di house, di builders dey build in vain. Unless Baba-God watch di city, di vigilante dey waste dia time. 2. E no-make-sense to wake up for early mor-mor, con come back late for night—dey hustle hard for food to chop—na Baba-God dey give rest to those pipo wey he love. 3. Na Baba-God dey dash pipo pikin, and babies blessings from Baba-God. 4. Pikin wey pesin born for hin youth—be like arrows for warrior hand. 5. Blessings for di man wey get plenty pikin like bag of arrow, shame no go catch dem wen dem…
-
Psalm Chapter 128
Pesin Wey Dey Respect Baba-God 2. Wen you chop di fruit of your hustle; you go jolly and e go beta for you. 3. For your house—your wife go be like tree wey dey produce plenty ripe fruit; your pikin go be like olive plant round your table. 4. Naso di blessing of di man wey dey fear Baba-God go be like. 5. Baba-God go bless you from Zion, and you go see di prosperity of Jerusalem all di days of your life. 6. You go live long to see your pikin-pikin. Make peace dey for Israel