Psalm Chapter 128

Abeg share

Pesin Wey Dey Respect Baba-God

  1. Dis na song of rising. Blessings for all di pipo wey dey fear Baba-God, wey dey waka for hin way.

2. Wen you chop di fruit of your hustle; you go jolly and e go beta for you.

3. For your house—your wife go be like tree wey dey produce plenty ripe fruit; your pikin go be like olive plant round your table.

4. Naso di blessing of di man wey dey fear Baba-God go be like.

5. Baba-God go bless you from Zion, and you go see di prosperity of Jerusalem all di days of your life.

6. You go live long to see your pikin-pikin. Make peace dey for Israel

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now