Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 143

    Hear My Prayer 2. No judge your servant, no-pesin for dis life dey good for your eyes. 3. Di enemy don show me pepper, he don nack me for ground; he make me stay for darkness like pipo wey don kpeme tey-tey. 4. So my spirit inside me don taya, and palava dey for my heart. 5. I remember olden days; I dey meditate on all your works, and I dey reason everitin wey your hand don make. 6. I carry my hands give you, my soul wan drink you like dry land wan drink water. 7. Oh Baba-God, ansa me kiakia, my spirit don dey give up. No hide…

  • Psalm Chapter 144

    David Dey Tank Baba-God 2. Nahin be my soft-love plus my strong house; my tall-building wey high and my saviour, my protection and nahin I dey hide my head put, and nahin dey put pipo under me. 3. Oh Baba-God, who be ordinary man wey you dey reason dem, or man pikin wey you go con dey tink of am? 4. Man be like breath, hin days be like shadow wey dey pass dey go. 5. Open your heavens, Oh Baba-God, make you come down; touch di mountains make dem smoke! 6. Send lightning to scata di enemies; shoot your arrow to scata dem. 7. Bring your hand come down…