Genesis Chapter 25
Abraham Oda Family
- So Abraham marry again, and her name na Keturah.
- And she con born Zimran for am, and Jokshan, plus Meda, and Midian, and Ishbak, plus Shuah.
- So Jokshan born Sheba plus Dedan. And Dedan sons na; Ashurim, plus Letushim and Leummim.
- And di sons of Midian na; Ephah plus Epher, and Hanoch, plus Abijah, and Eldaah. Na all dis be di pikin of Keturah.
- And Abraham give everitin wey he get to Isaac.
- But for di sons of hin side-chick wey Abraham get— Abraham give dem gifts, con send dem komot from Isaac hin son—go di east side—wen he still dey alive.
Abraham Kpeme
7. Abraham live for 175 years.
8. So Abraham die for beta old age, as old man, wen he don live long well-well, and he go meet hin ancestors.
9. Naso hin pikin Isaac plus Ishmael bury am for inside-rocks for Machpelah, for di land of Ephron—di sons of Zohar di Hittite—wey dey before Mamre.
10. Di land wey Abraham buy from di sons of Heth, na for there dem bury Abraham and Sarah hin wife.
11. And e happun sey afta Abraham die, Baba-God con bless Isaac, and Isaac stay near di well of Lahai-roi.
Ishmael Family
12. Na dis be di generations of Ishmael—Abraham pikin wey Hagar di Egyptian—Sarah house-girl—born for am.
13. And na dis be di names of di sons of Ishmael, based-on dia age. Di first born of Ishmael na: Nebajoth, and Kedar, plus Adbeel, and Mibsam.
14. And Mishman, plus Dumah, and Massa,
15. Hadar and Tema, Jetur, Naphish, plus Kedemah.
16. Na dis be sons of Ishmael, and na dis be di names of di twelve tribe leaders based-on dia towns, settlements and dia villages.
17. Ishmael live for one hundred and thirty seven years old before he kpeme, and he join hin ancestors.
18. Dem stay from Havilah reach Shur, wey dey before Egpyt, as you dey waka go Assyria—and he die for front of all hin brodas.
Isaac Born Ejima—boys
19. Na dis be di generations of Isaac—Abraham son. Abraham nahin born Isaac.
20. Isaac na forty years old wen he marry Rebekah as hin wife—di daughter of Bethuel—di Syrian of Padanaram—di sista of Laban di Syrian.
21. So Isaac beg Baba-God for hin wife, becos she no fit born pikin.
22. Naso di ejima con dey struggle wit each oda inside her belle, so she ask Baba-God about di mata, naso she tok sey, “Why dis kain tin dey happun to me?”
23. So Baba-God tell her sey, “Two nations nahin dey for inside your belle, and two different kind of pipo go separate from your belle. One go strong pass di oda one, and di senior one go serve di junior one.”
24. Wen time reach for her to born di pikin, na ejima [twins] con dey for inside her belle.
25. Di first one come out wit red color—and he get hair for body like sey he wear animal skin wey get plenty hair, and dem call hin name Esau.
26. Afta am, hin mama born hin broda wit hin hand wey dey hold hin broda leg. So dem call am Jacob. Issac na sixty years old wen hin wife born di twins.
27. Naso di boys grow, Esau con be good hunter, man of di forest, and Jacob con be jeje man wey like to dey house.
28. Isaac love Esau becos he dey chop di bush-meat wey Esau dey catch, but Rebekah love Jacob.
29. So Jacob cook stew, and Esau just come back from hunting, con taya.
30. Esau tell Jacob sey, “Abeg give me food from di same red stew, becos hungry dey beat me well-well. [Nahin make dem call am Edom.]
31. Jacob con tok sey, “Sell your right as firstborn for me today.”
32. Naso Esau tok sey, “See, na die I dey so, and who firstborn position epp?”
33. So Jacob tok sey, “Swear to me today.” And he swear to am, naso he take sell hin birth-right to Jacob.
34. So Jacob give Esau bread and some stew wey dem cook wit lentils. Esau chop, drink, con stand up dey go hin way. Naso Esau take fashi hin right as firstborn.