Hosea Chapter 12
Baba-God Change-am-for Ephraim, Judah, plus Jacob
- Ephraim dey pursue breeze, and he pursue di east breeze; day by day, he dey lie more-more and na scata-scata full hi hand; he dey make agreement wit Assyria, con send ororo go Egypt (becos dem wan try to be Egypt padi).
- Baba-God get mata against Judah. He go punish Jacob for hin ways, he go punish am based-on wetin he don do.
- He hold hin broda leg for inside hin mama belle, and he fight wit Baba-God wit hin pawa.
- Yes, he fight wit angel and he win; he cry and he ask for hin favour. And na for Bethel Baba-God take meet awa ancestor Jacob, con follow am tok for there;
- Even Baba-God wey be God Almighty. Baba-God na hin name.
- But you must go back to your God, to show love and give justice, and always trust your God.
- But he be market-pesin wey dey use mago-mago measurement; and wey love to oppress pipo.
- And Ephraim dey make-mouth sey: “See as I don rich reach! I don make moni for mysef. Dem no fit see any error wey I take commit any sin—for inside all my work.”
- But na me be Baba-God, una Oga, ever since di land of Egypt. I go make una stay for tents again, just like di days of una holy festivals.
- I tok tru di prophets, con give dem plenty visions; I give parables tru di prophets.
- Abi sin dey for inside Gilead? Dem go surely end up as notin. Abi dem dey sacrifice malu for Gigal? Dia altars go true-true scata like stones wey scata for open field.
- Jacob run go di land of Syria, and Israel work as servant go get wife—he take care of sheep to get wife.
- But Baba-God use prophet take carry Israel komot from Egypt, and he use prophet take save dem.
- Ephraim don make me vex well-well, so Baba-God go make am use hin head take carry di blood wey he don shed, con carry hin shame put on am.