Hosea Chapter 13

Abeg share

Ephraim Levels Don Komot

  1. Wen Ephraim tok, everi where dey shake; he bin get levels for Israel. But di pipo of Ephraim commit sin by worshipping Baal [idols], naso dem con dey kpeme.
  2. Now dem dey sin more-more, con make image wey dem cast wit silver. Dem design idols wit dia hand; all of dem na di work of artist. Pipo dey tok about dem—sey, dem dey tok sey, “Make di men wey dey sacrifice kiss di idol wey be like small-malu (to show respect)!”
  3. So dem go be like di morning cloud, like di dews for early mor-mor wey dey pass komot. Dem go be like chaff wey dem blow komot from di harvest ground, like smoke wey dey blow komot from window wey open.

Baba-God Dey Vex

4. But na me be Baba-God wey be una Oga—ever since di land of Egypt; and make una no get any oda God apart from me, becos no god dey save apart from me.

5. I know una for inside desert, for land wey water no dey.

6. Wen dem con get green-land, naso dem belleful, dia hearts con dey feel-big, nahin make dem fashi me.

7. So I go attack dem like lion; I go hide like leopard for corner of dia road.

8. I go attack dem like bear wey dem tiff e pikin, and I go tear dia chest open. I go chop dem fast-fast like lion for there—just as wild animal go take tear dem to pieces.

Baba-God Mercy

9. Oh Israel, una don scata unasef, but na me fit epp una.

10. I go be una king; where any oda king wey fit save una for all una cities, and di rulers wey una tok about sey, “Give us king and princes”?

11. So I give una king as I dey vex, and I carry am komot as I dey vex.

12. Di sins of Ephraim don gada; hin sins dey for store.

13. Di pain wey go dey on am be like di pain of woman wey wan born: na pikin wey no-get-sense, wen time reach for hin mama to born am, he no gree komot from hin mama belle!

14. Abi I go save dem from di pawa of grave; abi I go save dem from death. Oh death, where your disease? Oh grave, where your teeth? I no go sorry-for dis pipo again wen I look dem [becos dem no gree repent].

Judgement of Samaria

15. Even though he dey shine among hin brodas, one breeze [Assyria] from di east go show-face—breeze from Baba-God, wey go raise from di desert. Hin water wey dey flow go stop, and hin water wey dey komot from ground go dry. Breeze go blow all hin beta-beta-tins komot.

16. Di pipo of Samaria must carry dia sins for dia head, becos dem don turn komot from Baba-God. Na sword go kill dem; dem go tear dia small-small pikin to pieces, and dem go tear di belle of dia women wey get-belle.

Questions about Hosea 13

What is Hosea 13 in Pidgin Bible?

This page contains Hosea 13 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/hosea-chapter-13/

Where can I read Hosea 13 in Nigerian Pidgin?

You can read Hosea 13 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/hosea-chapter-13/

Which Bible book contains Hosea 13?

Hosea is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Hosea 13?

The chapter identified by this reference is 13.

Topics connected to this passage

  • Salvation
  • Forgiveness

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now