Isaiah Chapter 24

Abeg share

Baba-God Judgement On Di Earth

  1. See, Baba-God don make di earth empty, and he don turn am to waste, he don turn am up side down, and he don scata di pipo wey dey stay inside go far-far.
  2. Na di same tin go happun to both di pipo plus di priest, di same tin wit oga and hin servant, and na di same tin go happun to both madam and her maid, di same wit buyer and seller. And na di same tin go happun to both di pesin wey dey borrow moni and di pesin wey he dey borrow from. Naso e go be sef wit both di bankers and di customers.
  3. Di land go empty kpatakpata, and dem go obtain am finish; becos Baba-God don tok dis word.
  4. Di earth dey cry and e dey fade, di world dey suffer and e dey fade. Di pipo wey dey feel-big for di earth dey face suffer-head.
  5. Di pipo wey dey stay for di earth don spoil di world, becos dem don break di laws, dem don change Baba-God word, con break di everlasting agreement.
  6. Curse dey for di earth, and di pipo wey dey stay inside am go pay for di sins, so di pipo wey dey stay for di earth don burn finish [as Baba-God dey vex], and na only some pipo remain.
  7. Di fresh wine dey waste, and vine trees dey spoil; all di pipo wey bin dey jolly don dey cry.
  8. Di sweet sound of sheke-sheke don stop, di noise of di pipo wey dey flex don end, di sweetness of music instrument wey get string (harp)—don stop.
  9. Dem no go drink wine wit song, beer go dey bitter for di pipo wey dey drink am.
  10. Di city of katakata don break down, everi house don close sote no pesin fit enta.
  11. Dem dey cry for beer for street, all happiness don turn to darkness, di jolly-jolly for di land don vanish.
  12. Na only scata-scata brekete for di city, and dem don scata di gate.
  13. Naso e go be for di earth and among di pipo. E go be like wen dem shake olive tree—wen dem don pick di grapes from di tree and na only some remain.
  14. Dem [those wey escape] go raise dia voice, dem go sing for di levels of Baba-God as king, dem go cry loud cry from di big-river [Mediteranean sea].
  15. So make una give praises to Baba-God for di land of di east, give levels to di name of di Oga, Baba-God of Israel, for di islands wey dey for di big-river [Mediteranean sea].
  16. From di place wey far pass from di earth nahin we don hear songs, “Praise to Baba-God wey get clean-heart.” But I tok sey, “See me see trouble! See me see trouble! Wahala for me! Pipo wey dey betray still dey betray! True-true, betrayers dey betray more-more.”
  17. Fear and di pit, plus trap dey on una, chai, pipo wey dey stay for di earth.
  18. And e go happun sey any pesin wey run from di noise of di fear—go fall inside pit, and any pesin wey come out from di pit—go enta di trap; becos di windows wey dey up-up don open, and di foundations of di earth dey shake.
  19. Di earth don break down kpata-kpata, di earth don break to pieces, di earth dey shake well-well.
  20. Di earth go roll upandan like pesin wey don jogodo, and di earth go shift komot like small-house, naso di sin wey dey for di earth go heavy on am, e go fall and e no go rise up again.
  21. E go happun on dat day sey Baba-God go punish all di pipo wey dey for high place, and even di kings of di earth.
  22. Dem go gada dem togeda as dem take dey gada prisoners for underground prison, and dem go lock for inside prison, and dem go receive dia punishment afta many days.
  23. Di moon go dark, and shame go catch di sun, wen Baba-God Almighty go shine wit levels for mountain of Zion, and for inside Jerusalem, naso di senior-men go see am.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *