Jeremiah Chapter 47
Judgement On Di Philistines
- Baba-God message come meet prophet Jeremiah about di Philistines before Pharaoh attack Gaza:
- Dis na wetin Baba-God tok: “See, water dey rise from di north; dem go turn to big-water wey dey overflow. Dem go over-flow di land plus everitin wey dey for di land, di city plus those pipo wey dey stay for inside am. Di men go cry out; all di pipo wey dey stay for di land go cry.
- Dem go hear di noise as horse dey run, di noise of horse-moto, di sound of di rolling of tyres. Papa no go turn back to carry dia pikin, becos dia hands go dey shake wit fear.
- Becos di day don reach to scata all di Philistines, and no pesin go remain to epp di cities of Tyre plus Sidon. Baba-God go scata di Philistines, di pipo wey remain from di kontri of Caphtor.
- Gaza go shave her head gorimakpa; dem don silence Ashkelon wit di pipo wey remain for bottom-of-di-mountain: how long una go dey cut unasef [becos una dey cry]?
- Una go dey cry sey, ‘Ah, Baba-God sword, how long until you go rest? Go back to where you suppose dey, stay for there and make you rest!’
- But how e go fit rest wen Baba-God don send am to attack Ashkelon and di areas wey near water-side?”