Lamentation Chapter 3
Di Prophet Pain Plus Hope
- Na me be di man wey don chop di punishment of Baba-God koboko.
- He don pursue me komot, con make me waka inside darkness instead of light;
- True-true, he don turn hin hand against me again and again, from morning till night.
- He don make my skin and my flesh old and he don break my bones.
- He don round me and he don cover me wit sadness and suffer-head.
- He don make me live inside darkness like pipo wey don kpeme tey-tey.
- He don fence round me sote I no fit escape; he don press me down wit chains.
- Even wen I shout or cry for epp, he no dey listen to my prayer.
- He don cover my road wit block of stones; he don turn my road to bend-bend road.
- He be like bear wey dey wait for corner for me, like lion wey dey hide for corner.
- He drag me from my way, he tear my to pieces, con finish me kpatakpata.
- He set hin bow, con face hin arrow for my body.
- He shuuk my heart wit arrow from hin bag-of-arrow.
- All my pipo con dey laff me anyhow; dem dey yab me wit dia song from morning till night.
- He don full me wit bitter tins, con give me bitter cup of sorrow to drink.
- He don break my teeth wit gravel stone; he don cover me wit ashes.
- He no gree let me see peace; I don forget wetin prosperity mean.
- Naso I tok sey, “My pawa and my hope don finish for Baba-God.”
- I remember my suffer-suffer plus my waka-waka, na bitter hard life.
- I remember dem well-well, and my spirit kpanji.
- But I still dey hope wen I remember dis tins:
- becos Baba-God dey sorry-for pesin—nahin make us neva kpeme, hin soft-love no dey fail.
- Dem dey fresh everi morning and hin faithfulness na ogbonge.
- I tell mysef sey, “Baba-God nahin be my portion; so I go put my hope on am.”
- Baba-God dey good to those pipo wey dey hope on am, to di pesin [soul] wey dey fyne am;
- E dey good for man to hope, con keep quiet as you dey wait for Baba-God come save am.
- E good for man to use patience carry heavy load wen he dey young.
- Make he sidon alone wit silence, becos Baba-God don sama am.
- Make he bury hin face for dust—hope fit still dey.
- Make he carry hin cheek give pesin wey go nack am, and make he burku wit disgrace.
- Becos Baba-God no dey fashi any pesin forever.
- Even though he dey make yawa gas, he go still show love based-on how he take dey sorry-for pipo well-well.
- Evensef, he no dey bring suffer-suffer just like dat, or bring sadness to man pikin,
- to march prisoners for under hin leg,
- to cut man from hin right for front of di Most High,
- to carry justice from man. Baba-God no dey gree for all dis kain tins.
- Who fit tok, and make e happun if Baba-God neva confam am?
- Abi no be from di mouth of di Most High nahin both kasala and beta tins dey from come?
- Why any man wey dey alive go dey complain wen he receive punishment for hin sins?
- Make we check awa ways and make we test dem, con turn back go meet Baba-God.
- Make we carry awa hearts plus awa hands go up to meet Baba-God for heaven, con tok sey:
- “We don do bad tins, we no gree listen to you, and you neva forgive us.
- “You don cover yoursef wit vex and you don show us pepper; you don kill us wit-out sorrying for us.
- You don cover yousef wit cloud sote no prayer fit reach where you dey.
- You don turn us to yama-yama and dirty among di nations.
- “All awa enemies don open dia mouth wide against us.
- Fear nahin full inside us, we dey inside trap, we don finish kpatakpata, and we don kpafuka.”
- Water dey flow from awa eyes like river becos my pipo don scata.
- My eyes no go stop to dey flow wit water, wit no rest,
- Until Baba-God look down from heaven, con see.
- Wetin I dey see dey make my soul feel sad, becos of all di women wey dey for my city.
- Those pipo wey be my enemies for no reason dey hunt me like bird.
- Dem try to end my life inside pit, con dey stone me;
- di water con dey reach me for my head, and I con tink sey I go soon cut komot.
- I call your name, chai Baba-God, from deep inside di pit.
- You don hear my voice: “Make you no close your ears as I dey breath, or hide your ears from my cry for epp.”
- You come near wen I call you, and you tok sey, “No let fear catch you.”
- Oh Baba-God, you carry my mata for your head; you con save my life.
- You don see, Oh Baba-God, di wrong tin wey dem dey do to me. Carry my case!
- You don see as dem carry me for mind, plus all dia plans against me.
- Chai Baba-God, you don hear dia insults, all dia plans against me—
- Wetin my enemies dey tok small-small plus dia coded yarnings against me from morning till night.
- See dem! As dem dey sidon and dey stand, dem dey yab me wit dia songs.
- Pay dem back based-on wetin dem don do, Oh Baba-God, becos of wetin dia hands don do.
- Use sometin take cover dia hearts [make dem get stubborn heart], and make your curse dey on dia head!
- Pursue dem as you dey vex, con dabaru dem from under Baba-God heavens.