Luke Chapter 8
Di Parable Of Di Farmer
- Afta dis, Jesus travel upandan from one town to anoda, dey preach di truth about Baba-God kingdom. Di twelve disciples dey wit am,
- plus some women sef—wey he bin cure from evil spirit, plus diseases: Mary (wey dem dey call Magdalene) wey he pursue seven evil spirit from her body;
- Joanna, Cuza wife, di manager of Herod full house; Susanna; and many odas. Di women dey support am—wit dia own moni.
- As plenty pipo gada, and pipo dey come meet Jesus from town to town, he con tell dem dis parable:
- “One farmer komot—go plant hin seeds. As he dey throw di seeds for ground, some fall for road side; pipo con march dem, and di birds wey dey fly for air chop dem.
- Some fall for where stone dey, and wen dem grow small, dem die—becos water no dey.
- Oda seeds fall for shuku-shuku side, di shuku-shuku follow am grow, con shuuk di plant.
- Some oda seeds fall for beta soil. Dem grow, con produce fruit—times hundred of wetin dem plant.” Wen he tok dis one finish, he halla, “Pesin wey get ears to hear, make e listen, con understand.”
- So hin disciples con ask am wetin di parable mean.
- He ansa dem sey, “Baba-God don give una di knowledge of di secret of Baba-God kingdom, but I dey tok parables to odas, so dat, “ ‘Even though dem dey look, dem no fit see; even though dem dey hear, dem no go fit understand.’
- “Dis na di meaning of di parable: Di seeds na Baba-God word.
- Di seeds wey fall for road-side—na di ones wey hear di word, but naso devil con carry di word komot from dia heart, so dat dem no go believe—and get salvation.
- Di seeds wey fall around stone, na di pipo wey receive di word wit happiness wen dem hear am, but dem no get root. Dem believe small, but wen time reach for test—dem fall komot.
- Di seeds wey fall for shuku-shuku, na those pipo wey hear di word, but as dem dey go for road, worry-worry about life, moni, plus flexing—con press dia neck, and dem no con mature.
- But di seeds wey fall for beta soil, na those pipo wey get good heart, and clean heart—wey hear di word, wey hollam tight, and wey use patience take produce friuts.
Di Lamp For E Stand
16. “No-pesin go light candle, con cover am wit container, or put am under bed. Instead, he go put am for e stand, so dat those pipo wey enta—go see di light.
17. E no get wetin dem hide- wey no go come out, and notin wey dey coded—wey pipo no go know, or wey no go come out.
18. So make you dey use jeje reason how you dey listen. Any-pesin wey hear my word—go understand more, but those pipo wey no hear my word, even di small tin wey dem tink sey dem know—go komot from dem.”
Jesus Mama And Brodas
19. Now, Jesus mama and hin brodas come see am, but dem no con fit near am becos of di plenty pipo wey gada.
20. Pesin con tell Jesus sey, “Your mama and brodas dey stand for outside, dem wan see you.”
21. Naso he ansa dem, “My mama and brodas na those pipo wey dey hear Baba-God word, and wey practice dem.”
Jesus Make Di Strong-breeze Cool Down
22. One day, Jesus tell hin disciples sey, “Make we komot go di oda side of di river.” So dem enta inside boat—con dey go.
23. Sleep catch Jesus as dem dey move dia boat dey go. Strong- breeze con start to dey blow for di water, sote water con cover di boat, and bad tin fit happun to dem.
24. So di disciples go wake Jesus, dem con tok sey, “Oga, Oga, water wan carry us oh!” He stand up, con tell di strong-breeze, plus di water wey dey para—make dem stop; di strong-breeze kpanji, and everi-where con sengemenge.
25. He ask hin disciples sey, “Where una faith?” Wit fear and surprise, dem con dey ask demsef sey, “Who be dis? He dey command even strong-breeze, and water, and dem obey am.”
Jesus Heal One Man Wey Get Bad-spirit
26. Dem move dia boat go di area of Gerasenes wey dey di oda side of di river of Galilee.
27. Wen Jesus komot from di boat, one man wey get bad- spirits for di town come meet am. E don tey wey dis man wear cloth, or stay for inside house, but he dey stay for di graves inside rock.
28. Wen he see Jesus, he start to dey halla, he con kneel down for Jesus front, he dey shout on top of hin voice, ‘Wetin you want from me, Jesus—Son of di Most High God? I dey beg you, no show me pepper!”
29. Jesus command di evil spirit make e komot from di man. Many times di bad-spirit don hollam, and even though dem chain di man for hand and leg, con dey guard am—he go cut di chain, and di bad-spirit go carry am enta desert.
30. So Jesus ask am sey, “Wetin be your name?” He ansa, “Legion,” becos plenty bad-spirits don enta inside am.
31. Di bad-spirits con dey beg Jesus well-well make Jesus no command dem to go inside deep pit.
32. Plenty pigs dey chop for di corner of di hill. Di bad-spirits con beg Jesus—make he allow dem enta di pigs body, so Jesus tok sey make dem carry-go.
33. Wen di bad-spirits komot from di man, dem go enta di pigs body. Naso di pigs rush enta di water from di sharp end of di river, and dem drink-water-die.
34. Wen di pipo wey dey take care of di pigs see wetin happun, dem run go spread di gist for di town, and kontri-side,
35. di pipo con go see wetin happun. Wen dem meet Jesus, dem see di man wey di bad-spirits komot from hin body, dey sidon near Jesus leg, di man baffup, and he dey alright; fear con catch dem.
36. Those pipo wey see am—gist di pipo how di man wey bin get bad-spirit don dey okay.
37. Naso all di pipo for di area of Gerasenes con tell Jesus make he komot from dia area, becos fear don dey catch dem. So Jesus enta boat, con komot.
38. Di man wey bad-spirits komot from hin body—beg Jesus make he follow am, but Jesus sey make he dey go,
39. “Go your house, go gist dem di ogbonge tins wey Baba-God don do for you.” So di man go, con dey gist everi-pesin for di full town—about di plenty tins wey Jesus don do for am.
Di Girl Wey Die, Plus Di Woman Wey Dey Sick
40. Now as Jesus come back, plenty pipo welcome am, all of dem bin dey wait for am.
41. Naso one man wey dem dey call Jairus—wey be leader for di worship-place, con kneel down for Jesus front—con dey beg am to come hin house,
42. becos hin only daughter wey be twelve years, wan kpeme. As Jesus dey waka go there, di plenty pipo almost march am for ground.
43. And one woman dey for there—wey blood dey komot from her body for twelve years, but no- pesin fit heal her.
44. She go Jesus back, con touch small part of hin cloth, naso di blood wey dey komot from her body con stop.
45. So Jesus ask, “Who touch me?” Afta everi-pesin no gree tok, naso Peter tok sey, “Oga, pipo plenty, and dem even dey push you.”
46. But Jesus tok sey, “Pesin touch me; I know sey pawa don komot from my body.”
47. Wen di woman see sey Jesus must notice her, she con use fear kneel down near Jesus. For everi-pesin front, she con tok why she touch Jesus, and how she con sharply heal.
48. Naso Jesus tell her sey, “My daughter, your faith don heal you. Dey go in peace.”
49. As Jesus still dey tok, naso pesin just show from Jairus house—di leader for di worship-place. He con tok sey, “No disturb di teacher again. Your daughter don kpeme.”
50. As Jesus hear dis one, he tell Jairus sey, “No let your mind cut; just believe, and she go heal.”
51. Wen Jesus reach Jairus house, he no let any-pesin enta wit am—except Peter, John plus James, and di pikin papa and mama.
52. Water full all di pipo eyes, and dem cry for her well- well. Jesus con tok sey “Make una stop to dey cry, she neva kpeme, but she dey sleep.”
53. Dem laff am becos dem know sey she don die.
54. Naso Jesus hold her hand, con tok sey, “My pikin, stand up!”
55. Her spirit come back to her body, and she stand up sharp-sharp. Jesus con tok sey make dem give her sometin to chop.
56. Her mama and papa surprise, but Jesus tell dem sey make dem no tell any-pesin wetin happun.