Mark Chapter 5

Abeg share

As He Take Heal Di Man Wey Get Bad-spirit

  1. Dem go di oda side of di river—to di kontri of Gerasenes.
  2. Wen Jesus komot from di boat, one man wey get evil spirit come out from one grave—come meet am.
  3. Dis man dey live around di grave, and no-pesin fit tie am again, even wit chain.
  4. Dem dey always chain hin hand and hin leg, but he cut di chain, con break di iron wey dem put for hin leg. No-pesin get pawa reach to control am.
  5. For night and for day—for di graves and for di hills, he go dey halla, dey use stone dey cut hin body.
  6. As he see Jesus from far, he run con kneel down for Jesus front.
  7. He con dey halla wit loud voice, “Wetin you wan use me do, Jesus, Son of di Most High God? I dey beg you wit God make you no suffer me!”
  8. So Jesus tell am sey, “Oya komot from dis man  body—you evil spirit!”
  9. Naso Jesus ask am sey, “Wetin be your name?” He ansa, “My name na legion, we plenty inside dis man body.”
  10. Naso he dey beg Jesus—sey make he no pursue dem komot from di area.
  11. Plenty pigs dey chop for near di side of di hill.
  12. Di evil spirit con beg Jesus sey, “Send us go meet di pigs; Abeg allow us go enta dem.”
  13. So he con allow dem go, naso di evil spirits komot—go meet di pigs. So di pigs wey reach two hundred—run go enta di deep side of di river. And di water kill dem.
  14. Di pipo wey dey take care of di pigs run enta town, and village go tok wetin happun, and di pipo go see wetin happun.
  15. Wen dem reach where Jesus dey, dem see di man wey bin possess wit evil spirit, he baffup well con sidon, and he dey alright; fear con catch dem.
  16. Those pipo wey see wetin happun tell odas about di man wey evil spirit bin possess—dem tell dem about di pigs mata sef.
  17. So di pipo beg Jesus to komot for dia area.
  18. As Jesus dey enta di boat, di man wey evil spirit bin possess beg Jesus—sey make he follow dem go.
  19. Jesus no gree, but he tell di man sey, “Go house—go meet your family make you tell dem wetin Baba-God don do for you.”
  20. So di man con waka go—dey tell pipo for Decapolis wetin Jesus do for am. And everi- pesin surprise.

Di Girl Wey Die Plus Di Woman Wey Dey Sick

21. As Jesus use boat cross go di oda side of di river again, plenty pipo gada round am as he dey near di river.

22. Naso one of di rulers for di worship-place wey dem dey call Jairus come there. As he see Jesus, he kneel down,

23. con dey beg Jesus well- well, “My small daughter wan die. Abeg come lay your hand on her, so dat she go dey alright and make she dey alive.”

24. Naso Jesus follow am go. Plenty pipo dey follow am, and dey gada round am.

25. And one woman dey for there—wey blood dey rush komot from her body for twelve years.

26. She don suffer well-well for plenty doctors hand, and she don spend all di moni wey she get, instead of her to heal, her mata con dey worse more-more.

27. As she hear about Jesus, naso she waka go Jesus back from among di plenty pipo, con touch Jesus cloth,

28. becos she believe sey, “If I fit just touch hin cloth, I go dey alright.”

29. Naso di blood wey dey rush komot from her body just stop sharp-sharp, and she con feel for her body sey—her suffer-suffer don end.

30. Jesus notice sey pawa don komot from hin body. He look round di plenty pipo wey dey follow am, con ask dem, “Who touch my cloth?”

31. Hin disciples con ansa am, “Shebi you see as plenty pipo dey follow you, and you still dey ask sey, ‘Who touch me?’”

32. But Jesus con dey look round to see if he go see di pesin wey touch am.

33. As di woman see wetin happun to her, she con kneel down for Jesus front. Naso she use fear tell Jesus everitin wey happun to her.

34. He con tell her sey, “My daughter, your faith don heal you. Make you dey go in peace, and you no go suffer again.”

35. As Jesus still dey tok, some men waka come from Jairus house, wey be ruler for di worship-place. Dem con tell am sey, “Your daughter don die, why you still dey disturb di teacher?”

36. Jesus no-send wetin dem tok, he tell Jairus sey, “No let fear catch you; make you just believe.”

37. He no let any-pesin follow am go except Peter, James plus John wey be James broda.

38. As dem reach Jairus house, Jesus see di katakata, as pipo dey cry, con dey halla.

39. He waka go inside, con ask dem sey, “Why una dey cry like dis? Di pikin neva die, she just dey sleep.”

40. Naso dem laff am. Afta he tell all of dem make dem come outside, he carry di pikin mama and papa plus hin disciples wey dey wit am—go where di pikin dey.

41. He hold di babe hand, con tell her sey, “Talitha koum!” (wey mean sey, “Small girl, I sey make you stand up!”).

42. Naso di girl stand up, con dey waka. She be twelve years  old. All of dem surprise well-well—for wetin happun.

43. He con tell dem sey make dem no let any-pesin know wetin happun, and make dem give her sometin to chop.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *