Marriage
Dis na popular Bible verses about marriage.
Genesis 2:24 (Pidgin Bible) Nahin make man go leave hin mama plus papa, con gum-body wit hin woman to make dem one pesin.
Proverbs 18:22(Pidgin Bible) Pesin wey fyne wife don fyne beta tin, and he go receive favour from Baba-God.
Ecclesiastes 4:9–12 (Pidgin Bible) Two beta pass one pesin, becos dem go get beta pay from dia work. Even wen dem fall, one pesin go carry di oda pesin up, but wahala for di pesin wey dey alone, wen he fall and no pesin dey to carry am up. Evensef, if two pipo lie down togeda, dem go warm demsef, but how one pesin go fit warm hinsef. And if one pesin fight am con win am; two pipo go stand am; and rope wey dem make wit three wires no go quick cut.
Matthew 19:5–6 (Pidgin Bible) He con sey, ‘Nahin make man go leave hin papa and mama, and he go join wit hin wife, and di two of dem go turn to one body’ So dem no be two again, but one. So wetin Baba-God don join togeda, make no man separate am.”
Ephesians 5:22–25 (Pidgin Bible) Wives, obey your husband as you take dey obey Baba-God.
Ephesians 5:31–33 (Pidgin Bible) “Nahin make man go leave hin papa and mama, con go join-body wit hin woman, and di two of dem go turn to one body.”
Colossians 3:14 (Pidgin Bible) And wetin pass everitin be sey; wear love, wey dey tie all of us togeda in a perfect way.
1 Corinthians 13: 4–7 (Pidgin Bible) Love na patience, love dey kind. E no dey jealous, e no dey make-mouth, e no dey carry- shoulder. E no dey behave anyhow, e no dey selfish, e no dey quick provoke, e no dey carry evil for mind. Love no dey happy for evil mata, but e dey jolly wit truth. Love dey bear everitin, e always dey trust everitin, e always dey hope, and endure everitin.
Hebrews 13:4 (Pidgin Bible) Everi-pesin suppose respect marriage and dey faithful for marriage: but Baba-God go judge pipo wey dey sex-anyhow, plus pipo wey dey climb pesin husband or wife.
Malachi 2:15 (Pidgin Bible) Abi Baba-God no make dem as one, wit part of hin Spirit inside dem? So why he make dem one? Na becos he want good pikin. So guard your spirit, and let anytin betray di woman wey you marry for your youth.
1 Peter 3:7 (Pidgin Bible) Husbands, make una sef respect una wives as una dey live togeda, and treat dem wit understanding. She fit no-strong reach you, but she dey follow you share inside dis beta gift of life—so dat notin go block your prayers. Song of Solomon 8:6–7 (Pidgin Bible) . Na for under di apple tree I wake you [I wake you for my love]; Na there your mama born you; na for there she bring you out from her belle, and she born you. Put me like seal for your heart, like seal for your hand, becos love strong like death; jealousy hard like grave. Love dey flash like faya—like faya wey dey shine well-well.
Romans 12:10 (Pidgin Bible) Make una reason each oda mata wit love like brodas. And make una respect one anoda.
1 John 4:7 (Pidgin Bible) My love, make we love one anoda, becos love na from Baba-God, and everi- pesin wey dey show love na Baba-God pikin, and e sabi Baba-God.
Proverbs 5:18 (Pidgin Bible) Make your water dey blessed. And happy wit di woman wey you marry for young age.