Proverbs Chapter 18
Baba-God Name Na Strong Tall-house
- Man wey no dey relate wit pipo—dey do
only wetin dey for hin mind; he no dey gree
for any beta reasoning. - Mumu no like to understand, but dem only
like to tok wetin dey for dia mind. - Wickedness dey bring badbelle, and
shame dey bring disgrace. - Di words from man mouth be like water wey deep well-well, and di well of wisdom be like water wey dey flow.
- E no good to do partiality for wicked pipo,
or make you do ojoro wen you dey judge
man wey get clean-heart. - Mumu pesin mouth dey put am for
wahala, and hin mouth dey invite beating. - Mumu mouth nahin dey make am fall, and
hin lips na trap for hin soul. - Tatafo words be like small food wey dey
enta body. - Pesin wey dey slack for hin business na di
broda of pesin wey dey scata tins. - Baba-God name na strong tall-house,
pipo wey get clean-heart dey run enta
inside—and dem go dey safe. - Rich man wealth na hin strong city; and
dem dey reason am like high wall. - Before man fall, he dey always feel-big
for hin heart, and pesin must humble before
dem go give am respect. - Any-pesin wey ansa pesin before e hear
wetin di pesin wan tok—na mumu and
shame for am. - Man spirit go make am endure wen he
no-well, but who fit carry spirit wey don
taya? - Di heart of pesin wey get-sense dey gada
learning, and wise man ears dey fyne
knowledge. - Pesin gift dey open way for am, and e go
give am connection to bigmen. - Di first pesin wey judge mata dey be like
sey e dey right, until anoda pesin come ask
am question. - To throw coin dey settle mata, and e go
make strong pipo wey wan fight
demsef—dey on dia own lane. - Broda wey dey vex—dey hard to win
pass strong city, and quarrel dey separate
pipo like wen dem lock di gate of strong-
house. - Wetin man dey tok nahin go make am
belleful; di right words wey he tok—dey
make am get yanfu-yanfu. - Di tongue get pawa of life and death, and
those pipo wey love to tok, go chop di fruit of
dia words. - Pesin wey fyne wife don fyne beta tin,
and he go receive favour from Baba-God. - Poor man dey beg for mercy, but bigman
dey ansa am in a rugged way. - Man wey get plenty padi must sabi rub-mind wit pipo, but e get padi wey dey close pass broda.
Questions about Proverbs 18
What is Proverbs 18 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 18 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-18/
Where can I read Proverbs 18 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 18 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-18/
Which Bible book contains Proverbs 18?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 18?
The chapter identified by this reference is 18.
Topics connected to this passage
- Love
- Wisdom
- Strength
- Family
- Money
- Guidance