Matthew Chapter 19
Divorce
- Wen Jesus don tok dis tins finish, he komot from Galilee, con go around Judea—for di oda side of di Jordan.
- Plenty pipo follow am, and he heal all of dem for there.
- Some Pharisees come meet am to test am. Dem ask am sey, “E dey right for man to pursue hin wife komot for any and everi reason?”
- Jesus ansa dem, “Una neva read sey from starting, Baba-God ‘make man and woman.’
- He con sey, ‘Nahin make man go leave hin papa and mama, and he go join wit hin wife, and di two of dem go turn to one body’
- So dem no be two again, but one. So wetin Baba-God don join togeda, make no man separate am.”
- Dem con ask am, “Why e be sey Moses tok sey man fit give hin wife certificate of divorce, con pursue her komot?”
- Jesus ansa dem, “Moses allow una pursue una wife komot, becos una heart strong. But no be so e be from di starting.
- I dey tell una sey any- pesin wey pursue hin wife komot, except she dey unfaithful, con marry anoda woman— dey commit adultery.”
- Di disciples con tell am sey, “If naso husband and wife mata be, e go beta make pesin no marry.”
- Jesus con ansa, “No be everi-pesin go like dis tok, but only those pipo wey fit accept am.
- Some pipo be eunuch wey dem born dem like dat; and some pipo be eunuch becos na men make dem be like dat; and odas be eunuch becos of di kingdom of heaven. Pesin wey fit accept am—make e accept am.”
Jesus And Di Small Pikin
13. Dem carry small small pikin come meet Jesus make he lay hin hands on dem, con pray for dem. But di disciples change-am-for di pipo wey carry di small pikin come.
14. Jesus con tok sey, “Make di small small pikin come meet me, and make una no block dem from di kingdom, pipo like dem nahin get di kingdom of heaven.”
15. Wen he don lay hin hands on dem con bless dem, naso he waka komot from dat side.
Di Young Man Wey Get-moni
16. Naso one man come meet Jesus, con ask am sey, “Teacher, which good tin I must do to get life wey go last forever?”
17. Jesus ansa am, “Why you dey ask me about wetin dey good? Na only one Pesin good—only Baba-God. If you wan enta di life wey dey last forever, obey di commandments.”
18. Di man con ask am, “Na which one?” Jesus ansa am sey, “ ‘No kill pesin, no commit adultery, no tiff, no lie for pesin head.
19. Respect your papa and your mama,’ and ‘love your neighbour as you take love yoursef.’ ”
20. Di young man con tok sey, “I don do all dis tins. Wetin still remain for me to do?”
21. Jesus ansa am, “If you wan dey perfect, go sell everitin wey you get make you give poor pipo, and you go get beta-beta-tins for heaven. Den come follow me.”
22. Wen di young man hear wetin Jesus tok, he con dey feel sad, becos he get-moni well-well.
23. Naso Jesus tell hin disciples sey, “I dey tell una, true- true, e dey hard for bigman to enta di kingdom of heaven.
24. I dey tell una sey, e easy pass for camel to pass tru di eye of niddle, dan for bigman to enta Baba-God kingdom.”
25. Wen di disciples hear wetin he tok, dem surprise well- well con ask am sey, “So who fit get salvation?”
26. Jesus look dem, con tok sey, “Dis tin no dey possible wit man, but everitin dey possible wit Baba-God.”
27. Peter ansa am, “We don leave everitin wey we get—con follow you! Wetin we go con gain?”
28. Jesus con tell dem sey, “I dey tell una di truth, wen all tins go dey new again, wen Man-pikin go sidon for di king-chair wey get levels, una wey don follow me—go sidon for twelve king-chair sef, to judge di twelve tribes of Israel.
29. Any-pesin wey don leave houses or brodas, or sistas, or papa, or mama or pikin or land becos of me, go get hundred times more, and he go inherit everlasting life.
30. But many pipo wey be di first—go be last, and many pipo wey be last—go be first.