Matthew Chapter 20

Abeg share

Di Parable Of Di Workers And Di Grape-farm

  1. “Di kingdom of heaven be like landlord wey komot for early morning to employ workers make dem come hustle for hin grape-farm.
  2. He agree to pay dem one denarius for di day, con tell dem sey make dem go start di work.
  3. “Around nine o’clock, as he komot go market side, he con see some oda workers wey no dey do anytin.
  4. He con tell dem sey, ‘Make una sef go work for my grape-farm, and I go give una wetin una suppose collect.’
  5. Naso dem waka go work. “He komot again around twelve o’clock and three o’clock, and he do di same tin.
  6. Around five o’clock, he still komot, con still see some workers wey just dey for street. He ask dem, ‘Why una just stand for here since morning, una no dey do anytin?’
  7. Dem ansa am sey, “ ‘We no see pesin to give us work.’ “He con tell dem sey, ‘Make unasef go work for my grape-farm.’
  8. “Wen evening reach, di owner of di grape-farm con tell hin supervisor, ‘Call di workers make you give dem dia moni, start from di last one wey I employ to di first one.’
  9. “Di workers wey dem employ around five o’clock come out, con collect one denarius.
  10. So wen all those pipo wey dem first employ come out, dem dey expect to collect more moni. But all of dem still collect one denarius.
  11. Wen dem collect am, dem con start to dey grumble for di owner of di farm.
  12. Dis men wey you employ last—dem work only for one hour, and you give dem di same moni wey you give us—wey work pass dem for under sun since morning.
  13. “But he ansa one of dem, ‘Padi, I no do una ojoro. Abi no be una agree to work for dat amount?
  14. Collect your moni make una dey go. I wan give di man wey I employ last—di same moni wey I give una.
  15. Abi I no get di right to spend my moni di way I like? Abi you dey look me wit bad-eyes becos I dey do good?’
  16. “So di last go be di first, and di first go be di last.”

Jesus Predict Hin Death Again

17. Now, as Jesus dey go Jerusalem, he carry di twelve disciples go one corner con tell dem sey,

18. “We dey go Jerusalem, and pesin go betray Man-pikin to di chief priests and di teachers of di law. Dem go condemn am to death,

19. and dem go carry am give world-pipo make dem yab am, flog am, con hang am for cross. He go raise up back to life on di third day!”

Wetin Pesin Mama Dey Ask For

20. Zebedee wife come meet Jesus wit her pikin, she kneel down for hin front con ask am for favour.

21. So Jesus ask her, “Wetin you want?”

She con tok sey, “Make one of di two of my pikin sidon for your right side, and di oda one go sidon for your left side for inside your kingdom.”

22. Jesus ansa dem sey, “Una no know wetin una dey ask for. Abi una fit drink di cup wey I wan drink so?” Dem ansa, “Yes we fit.”

23. So Jesus tok sey, “Una go really-really drink from my cup, but to sidon for my right or left hand, no be me go decide dat one. Dat place belong to those pipo wey my Papa don arrange am for.”

24. Wen di oda ten disciples hear wetin happun, dem con dey vex for di two brodas.

25. Jesus call all of dem togeda, con tell dem sey, “Una know sey di rulers of world-pipo dey use gragra for dem, and dia govment-pipo—dey use pawa control dem.

26. But no be so wit una. Instead, any-pesin wey wan be great pesin among una—must be una servant,

27. and any-pesin wey wan be di first must be una slave—

28. just as Man-pikin no come so dat pipo go serve am, but he come to serve pipo, and to give hin life as payment for plenty pipo.”

Two Blind Men See Again

29. As Jesus and hin disciple con dey komot from Jericho, plenty plenty pipo follow dem.

30. Two blind men dey sidon for di corner of di road, and wen dem hear sey Jesus dey pass, dem con dey halla, “Jesus, son of David, sorry-for us!”

31. Pipo change-am-for dem sey make dem sharrap, but dem con dey shout more-more, “My Oga, David Pikin, sorry-for us!”

32. Naso Jesus stop, con call dem. He ask dem sey, “Wetin una wan make I do for una?”

33. Dem tok sey, “Oga we wan make awa eyes open.”

34. Jesus sorry-for dem, con touch dia eyes. Sharp-sharp naso dem start to dey see. Dem con dey follow Jesus.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *