• Isaiah Chapter 30

    To Depend On Egypt Na Waste of Time Pipo Wey No Dey Gree For Baba-God 8. Now go write am for dem for table, and write am down for book, so dat e go dey for future and forever, 9. sey dis na pipo wey no dey obey Baba-God word, lie-lie pikin, pikin wey no dey hear di law of Baba-God: 10. Dem dey tell di prophets sey, “Make una stop to dey see visions. No tell us about di right tins, tell us tins wey go make body sweet us. Tell us lies. 11. komot from road, no dey block awa way, no dey tell us about di Holy…