• Jeremiah Chapter 13

    Di Linen Belt Di Bottles of Wine 12. “Tell dem sey—na wetin Baba-God, di God of Israel tok, ‘Everi bottle go full wit wine.’ And if dem tell you sey, ‘Before-nnkor, abi we no know sey everi bottle suppose full wit wine?’ 13. Den tell dem sey—na wetin Baba-God tok, ‘I go full everi pesin wey dey stay for di land wit highness, plus di kings wey dey sidon for David king-chair, di priests, di prophets, plus all di pipo wey dey stay for Jerusalem. 14. I go nack dem togeda, even papa plus pikin—naso Baba-God tok, I no go sorry-for dem, or stop, or pity for dem, but I…

  • Jeremiah Chapter 14

    No-water, Hunger, Disease, plus Sword Di pipo Dey Beg Baba-God For Mercy 19. Abi you don fashi Judah kpatakpata? Abi you hate Zion? Why you don suffer us sote we no fit heal? We hope for peace, but no beta tin don show-face. We hope for time wey we go heal, but na only wahala we dey see. 20. Oh Baba-God, we accept sey we don do bad-bad-tins, and di bad-bad-tins wey awa papa-papa-papa do; we don true-true sin against you. 21. No hate us, sake of your name, no disgrace your king-chair wey get levels. Remember your agreement wit us and no break am. 22. Abi any of di…