-
Jeremiah Chapter 21
Jerusalem Go Fall For Babylon Message To Di House Of David 11. Still tell di house of Judah sey, ‘Hear Baba-God word; 12. Oh house of David, na wetin Baba-God tok be dis: Give justice to di pipo wey una dey judge everi morning. Epp those pipo wey dem don rob; save dem from di pipo wey dey oppress dem. Unless I go vex like faya wey no dey off—becos of all una sins. 13. See, I dey against you Jerusalem, una wey dey stay for strong-house—di pipo wey dey make mouth sey, “No pesin fit touch us for here. No pesin fit break enta here.” 14. I go punish…
-
Jeremiah Chapter 22
Warning Against Di Kings of Judah Warning About Di Palace 6. Becos dis na wetin Baba-God tok about di palace of di king of Judah, “Even though I love una like Gilead plus di green fine mountains of Lebanon, I go surely make una be like desert, like towns wey no pesin dey stay. 7. I go send pipo wey go scata una to come meet una, everi man go carry hin weapon to scata una. Dem go tear all una fine cedar pillars komot, con burn dem wit faya. 8. Pipo from many nations go pass near dis city, con dey ask demsef sey, ‘Why Baba-God do dis kain…