• Daniel Chapter 10

    Daniel Vision of One Messenger Di Prophecy About Persia Plus Greece 10. Naso ne hand touch me, con dey make my hand and knees shake. 11. He con tell me sey, “Oh Daniel, you get levels and Baba-God love you well-well, reason dis word wey I wan tell you—well-well, and stand up, becos Baba-God don send me to you.” And wen he tell me dis tin, naso I stand up wit fear. 12. So he kontinu, “Daniel, no let fear catch you. Since di first day wey you put-mind to understand and to humble yoursef for Baba-God front, Baba-God don hear your words, and I don come give you ansa.…

  • Daniel Chapter 11

      Di Kings Of Di South Plus North Di King Wey Dey Carry Shoulder up 36. ‘Di king go do wetin he like. He go carry hinsef up—pass any god, and he go tok tins to downgrade di God of gods, and e go succeed, until Baba-God stop to dey vex, becos Baba-God go do wetin he don plan. 37. He no go respect di gods of hin ancestors, or di gods wey di women like, and he no go respect any god, but he go carry hinsef high pass all of dem. 38. But instead of dem, he go respect di god of Maozim; god wey hin papa-papa-papa bin…