• Hosea Chapter 1

    Hosea Wife Plus Pikins Israel Go Come Back 10. But di pipo of Israel go be like sand-sand for beach, sote dem no fit count dem or numba dem. And e go happun sey, for di place  wey Baba-God dey tell dem sey, “Una no be my pipo,” but na for there he go tell dem sey, “Una be di pikin of di God wey dey alive.” 11. Naso di pipo of Judah plus di pipo of Israel go come togeda again, dem go choose one leader, and dem go come out of di land: becos di day of Jezreel go great.