Proverbs Chapter 10
Solomon Proverbs: Wise Pikin
- Proverbs of Solomon: Wise pikin dey give
hin papa joy, but mumu pikin dey make hin
mama sad. - Property wey pesin obtain—na waste, but
clean-hands dey save pesin from death. - Baba-God no go let hungry beat good
man, but he dey dabaru badbelle pipo wish. - Lazy hands dey make man poor, but hand
wey dey do business dey bring moni. - Any-pesin wey dey work hard for harvest
season—na wise pikin, but pesin wey dey
sleep for harvest na pikin wey dey bring
disgrace. - Blessings na crown for good pesin head,
but fight- fight nahin full badbelle pipo
mouth. - Di memory of good pesin na blessings, but
di name of badbelle pipo go fade. - Pesin wey wise for hin heart go receive
teaching, but mugu wey dey tok-tok go fall. - Pesin wey get clean- heart dey waka wit
safety, but dem go catch pesin wey hin way
get k- leg. - Pesin wey dey look pesin wit bad-eyes
dey cos wahala, and mumu pesin wey dey
miss-yarn go fall. - Good pesin mouth na well of life, but
fight-fight nahin cover evil pesin mouth. - Hatred dey ginger quarrel, but love dey
cover all wrong tins. - Wisdom dey for di lips of pipo wey get
understanding, but koboko nahin good for
mumu pesin back. - Wise men dey gada knowledge, but mumu pesin mouth no far from scata-scata.
- Bigman moni dey for hin strong city,
but poverty of poor pipo nahin dey kill dem. - Good man hustle dey bring am life, but
badbelle pesin salary na sin. - Pesin wey dey accept discipline, dey
waka for di way of life, but any-pesin wey no
wan gree accept correction—go waka miss-
road. - Lie-lie full di lips of any-pesin wey carry
pesin for mind, and any-pesin wey dey do
tatafo na mugu. - Plenty tok dey bring sin, but any-pesin
wey hold hin tongue na wise pesin. - Good man tongue na fine silver, but
badbelle pesin heart na gbanjo. - Good man lips dey feed plenty pipo, but
mugu dey kpeme becos dem no get-sense. - Baba-God blessings dey bring wealth
wit-out sadness. - To do evil tin be like sport for mugu, but
man wey get understanding get wisdom. - Wetin wicked man dey fear nahin go kill
am las-las; wetin righteous pesin really
want—nahin he go get. - Afta rolling-breeze don sweep go,
badbelle pipo sef go follow am go, but good
m a n get ever lasting foundation. - As sawa drink be for teeth, and as smoke
be for eyes, naso lazy man sef be—to di pipo
wey send am. - If you respect Baba-God, you go live
long, but badbelle pipo life no dey last. - Good man hope dey bring happiness, but
wicked man hope go kpeme. - Baba-God way na pawa for pipo wey get
clean- heart, but scata-scata na di destiny of
pipo wey dey do evil tins. - Good man root no go fit ever komot from
ground, but badbelle pipo no go stay for dis
earth. - Good man mouth dey bring wisdom, but
corrupt tongue go cut komot. - Good pesin lips dey tok beta tin, but na
only bend-bend tok nahin dey for wicked
man mouth.