Proverbs Chapter 11
Measurement Wey No Correct Na
Tufiakwa
- Ojoro measurement na tufiakwa for Baba-
God, but correct measurement dey make
belle sweet am. - Wen pesin start to dey feel big, na disgrace go meet am, but jeje way dey make pesin
- wise.
- Di clean-heart of good pipo dey guide
dem, but di wuru-wuru of unfaithful pipo
dey dabaru dem. - Moni useless for di way wey Baba-God
dey vex, but na goodness dey save pesin
from death. - Di goodness of pesin wey get clean-hand,
dey make dia way straight for dem, but
badbelle pipo dey fall becos of dia
wickedness. - Di good tins wey beta pipo dey do—nahin
dey save dem, but evil pipo dey fall for di
trap of di evil tins wey dia body dey scratch
dem to do. - Wen wicked pesin die, hin hope don
kpeme, and di hope of badbelle don finish. - Good man go save from palava, but
badbelle pipo go use dia head carry di
palava. - Fake-pesin dey use hin mouth take spoil
hin neighbour, but good man go use wetin he
know take escape from evil. - Wen e beta for good man, di city go dey
happy; wen badbelle pesin kpeme, everi-
pesin go dey jolly. - Na di blessings of beta [righteous] pesin
nahin dey give city levels, but wicked pipo
mouth—nahin dey bring city down. - Pesin wey no get-sense dey yab hin
neighbour, but man wey get understanding
go keep quiet. - Tatafo dey betray trust, but man wey get
faithful spirit dey keep secret. - Nation dey fall becos no good leader to
guide dem, but di pipo go dey safe wit plenty
advisers. - Pesin wey do guarantor for stranger go
pay for am, but pesin wey no do guarantor go
avoid wahala. - Pipo go respect woman wey get kind
heart, but badmen go gain only moni. - Man wey kind dey do tins wey he go gain
from, but badbelle pipo dey carry wahala put
for dia own head. - Wicked man dey do wayo, but any-pesin
wey plant goodness go get hin blessings wey
sure. - Good man go gain life, but pesin wey dey
follow evil—dey fyne hin own grave.
20.Pipo wey get bend-bend heart na
tufiakwa for Baba-God, but he love those
pipo wey no get error for dia way. - Even though dem join dia pawa togeda, wicked pipo must receive dia pay. But di future of good pesin dey secured.
- Fine girl wey no get- sense be like gold
ring for pig nose. - Good man wish dey always end up wit
good tins, but wicked man hope dey end wit
vex. - One man dey give from hin heart and he
dey get more-more; but anoda man na
alaroro, and naso he con poor las-las. - Man wey dey give wit open-heart go
prosper; pesin wey water pipo—dem go
water am sef. - Pipo go curse man wey dey hide food, but
blessings dey on di head of di man wey like
to sell. - Pesin wey serious dey fyne beta tins go
see alubarika (blessings), but yawa dey
come meet pipo wey dey fyne evil. - Any-pesin wey trust hin moni go fall, but
good pipo go grow like green leaves. - Pesin wey carry wahala put for hin
family—go inherit breeze, and mugu go be
wise man servant. - Di fruit of good pipo na tree of life, and
any-pesin wey win soul—get-sense. - If good pipo dey reap wetin dem sow for
earth, wetin go con happun to di pipo wey
don fashi Baba-God, plus sinners!