Proverbs Chapter 12
To Love Discipline Plus Knowledge
- Any-pesin wey love teaching—love to
learn, but any- pesin wey hate correction na
dondi. - Good man go get favour from Baba-God,
but Baba-God dey condemn korni-korni
man. - Man no-fit make am wit evil way, but good
man root no go ever komot for ground. - Wife wey get beta character na crown for
her husband, but woman wey dey bring
disgrace—be like bone wey don spoil. - Good man tinking na correct tinking, but
wicked man advice na wayo. - Evil man words na to shed blood, but good
man words dey save dem. - Dem go overthrow wicked men, and dem
no go ever dey again, but good man family
go stand gidigbam. - Dem go cut-cap for man based-on hin
wisdom, but pipo hate men wit bend-bend
mind. - E beta make you dey low-key and make
you get servant, dan make you dey pretend to be somebody—but you no get food. - Good man dey care for wetin hin animal
need, but di beta tin wey wicked man fit
do—na wickedness. - Pesin wey hustle for hin land go get food
burku, but any-pesin wey dey use hin take
life play—no get-sense. - Wicked men wan obtain wetin evil men
obtain, but good pipo root go prosper. - Badbelle pesin miss- yarn dey put am for
wahala, but good man dey escape from
palava. - Di wise words from man lips—nahin dey
make am belleful wit beta tins, and di
handwork of man go pay am. - Mugu dey always feel sey hin way dey
right, but wise men dey hear advice. - Mugu dey quick vex, but man wey get-
sense go use- style cover shame—even if
dem insult am. - Pesin wey get clean-heart dey tok true,
but fake witness dey tok lie. - Miss-yarn dey shuuk like knife, but wise
man tongue dey heal. - Truth dey last forever, but tongue wey
dey lie—no dey last. - Wayo nahin brekete for di mind of pipo
wey dey plan evil tins, but happiness dey for
pipo wey dey promote peace. - No yawa go meet pipo wey get clean-
heart, but yawa nahin burku for badbelle
pipo. - Mouth wey dey tok lie na tufiakwa for
Baba-God, but he like men wey dey tok true. - Wise man dey keep wetin he know, but
mumu heart dey show dia kolomentality. - Hand wey dey hustle go rule, but pipo
wey lazy—go las-las do slave labour. - Worry-worry dey bring man down, but
beta words go make am happy. - Good man suppose use jeje choose hin
padi, becos badbelle pipo way—dey make
dem waka miss-road. - Lazy man no get time to roast hin bush-
meat wey he catch, but di life of serious man
na business. - Life dey for di beta way; for dat road wey
dey lead to everlasting life.